+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Go Support John Dumelo To Be MP For 2024 Election, Actor Prince Osei

Ghana actor wey dey with di New Patriotic Party, Prince David Osei say hin don troway support go meet him colleague for film industry John Dumelo.

Dumelo dey contest under di National Democratic Congress to come out as parliament member wey go rep Ayawaso West Wuogon Constituency.

Actor Osei wey bin don dey support di ruling NPP member Lydia Seyran Alhassan but he say dem don fail to meet wetin di constituency dey luk for.

He say he try all hin best to tok with Lydia wey be di seating member for di parliament about issues wey dey on ground especially di ones wey concern University of Ghana students, but she nor gree hear.

“For me I nor go shock of you see me dey campaign for John to win Ayawaso seat even if he nor be member of NDC. I be NDC but I go support John. No fear if e happen cus I fell say if pipo fit do anytin for you make you nor troway dem. I stand for that platform and many pipo dey curse me cus of Maa Lydia.

“E reach one point nai I send message to her tru her PA to tell her wetin Legon students dey face. I don dey try to support. Na you be MP so make you hear wetin pipo dey cry, but dem never hear,” Osei tok.

Lydia Alhassan go face John Dumelo for di 2024 parliament if she win di NPP primary election wey dem go do for January 20, 2024.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM