+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Security Tiff Dollars For Nasarawa Deputy Gov Office

Di Deputy Govinor of Nasarawa State, don cry say pipo don tiff big amount of dollars for hin office.

Tori say di Deputy Govinor, Dr Emmanuel Agbadu Akabe, don already give time frame wey di pipo wey tiff di moni to return am.

One aide wey dey close to Agbadu say di moni pass N20 million wey di pipo tiff.

Di source say na two security aides and one protocol officer wey dey for di deputy office nai plan tiff di moni before dem go Christmas break.

Di aide say make dem nor call e name cus dem nor tell am to tok di mata outside, say di teree pipo tiff di monie come share am with demsef.

He say di security aides nai kolet di lion share, dem come use am buy moto and okada, while di protocol officer use e share of N3.5 million but hass.

Dem say di moni wey di pipo tiff na foreign currency weh oyibo bring to invest inside Lithium wey dem dey see for inside Nasarawa State.

Afta di meeting nai di deputy govinor nai dem leave di bag of moni wey di teree companies bring come concerning di case of who go first dig for di land.

Naso di source say come say, hin believe say di resin wey make dem leave di moni for di office na cus dem wan set di Deputy up.

Sha, investigation don start and di teree pipo wey tiff di moni confess say dem don share am between demsef.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM