+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

67 Passengers For Port-Harcourt Fear As Plane Komot From RunWay

No be small fear nai enta di heart of pipo wey dey inside ValueJet, CRJ 900 Bombardier plane as e try to land for Port Harcourt International Airport but run komot from runway.

62 passengers and 5 crew members nai dey inside di plane with registration nuba 5N-BXR, as dem dey try to land for di runway nai di plane take land miss.

Notin do di plane wey e land but di passenger all of dem come dey wonder wetin happen.

But di Managing Director of ValueJet, Capt. Dapo Majekodunmi for statement say Captain Stanley Balami explain say na cus of tebetebe wey dey di road wey di road nai make dem nor fit see di center line well.

Majekodunmi say make pipo nor fear as dem won na safety first and all dem operations still dey normal as e be before.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM