+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

National Grid Dey On, TCN Change Mouth

As strike nai Nigeria Labour Congress and Trade Union Congress dey share to dem members, di Transmission Company of Nigeria, TCN wey say dem off lite don change mouth.

Today TCN bin tok through dem tokpesin, Ndidi Mbah, to Daily Post say dem wey dey work for lite side off di lite so that dem go follow for di infinite strike wey wey NLC and TUC put today.

But mouth don change mouth for new statement wey di TCN management bring as dem say dem dey give lite power to all di distribution centers wey dey di kontri.

“We wan tell una say notin happen to di national grid and e dey even supply boku lite give centers for di kontri.

“Di time wey we dey write dis statement, TCN for Osogbo wey dey give many part of di kontri lite tanda dey work.

“Make una dey use sense take dey know wetin to tok make problem nor go dey,” nai dey for di statement.

Di time wey dis tori dey drop down side of Federal Capital Territory, FCT, don get lite while many part of di kontri still dey for darkness.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM