+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

No Fear For Di Old N200, N500, N1000 —CBN

Central Bank of Nigeria, say shaking nor dey for di old N200, N500, and N1000 monie as pipo go fit use am pass di December 31, 2023 wey court give.

For statement wey di Director of Corporate Communications, Dr Isa Abdulmumin release on Tuesday, nai e take say bank go still dey give and kolet di old and new monie.

Come say, even wetin court judge about di old monie CBN dey waka to make sure say that ruling komot.

Remember di way pipo take suffa for February this year after di foma Govinor of CBN, Godwin Emeifele say bank don bring new monie and dem nor wan kolet di old monie again.

No be small shege banza nai ordinary Nigeria man see, cus di new monie come hard to get and di old one pipo wey dey sell nor gree kolet am.

Wetin come even make mata worse sef, na di POS pipo wey come dey use N5000 to kolet N10,000. That one one come mad pipo more as di new naira nor bodi dey even use eye see am.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM