+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

9 Students Wey Gunmen Tiff For Ughelli Road Don Get Freedom

Di 9 student wey men of gun tiff along East-west road for Ughelli, Delta State, Police don rescue dem..

On Friday nai men with gun attack di students wey dey travel inside small bus, tiff dem karey go hide somewhere.

Di student dey travel dey come from dem skool for Calabar bifor dem enta di robbas hand.

Afta Channels TV don tok about di student wey gunmen tiff nai police jump enta di mata.

On Monday nite nai DSP Bright Edafe, di Public relations officer for di state say all di nine students plus di driver don dey free.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM