+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Senegal President Show Hin Two Wives To Pipo

As di two wives of Senegal man, Bassirou Diomaye Faye wey go soon be president come out with him two wives, pipo don dey surprise put hand for mouth.

Wey dem dey do campaign naso 44 years Faye say hin go bring change for di kontri.

Marie Khone and Faye don dey togeda for 15 years and dem get four children bifor Faye dey marry new wife, Absa, just one year ago.

Di kontri of Senegal nor really see say man marry more than one wife as problem since many of dem na Muslim and e nor dey against dem tradition.

Still ontop that, e still get some pipo for Senegal wey nor gbadu man marry more than one wife as dem say na bad treatment to women.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM