Rivers State govinor, Siminalayi Fubara, wey lawmakers dey fight to komot, don go meet Minister of Federal Capital Territory, Nyesom Wike wey be di foma govinor for di state on Tuesday.
Na for Presidential Villa nai Wike and Fubara take dey shake hand as dem dey one start meeting.
Dem start dis meeting just afta di Rivers State House of Assembly start process to impeach Govinor Fubara komot from seat on Monday, October.
Gist go soon drop…