+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Abeg Gov Yusuf Come Join Awa Party–APC National Chairman

Di foma Govinor for Kano State wey be di National Chairman of All Progressive Congress, APC, Abdullahi Ganduje,  dey beg Govinor Abba Yusuf for Kano make hin komot from e party di New Nigeria Peoples Party, NNPP, come join APC.

Afta meeting wey Ganduje do with some of di pipo wey work with am for e time join with Govinor Yusuf for close door, nai e take tell tori pipo say dem don open hand for APC to welcome Yusuf for dem party.

He still tell pipo wey dey dem own APC party wey dey vex about di jorjimet wey Supreme Court give say na Yusuf win, make dem see am as God way and thank God for am.

Ganduje word, “We dey beg those wey wan join APC to come join, na beg we dey.

“Especially, we want make Govinor of Kano State and e NNPP pipo o come join APC.”

If you remember, e nor tay wey Supreme Court stamp Yusuf say naiem be di real winner of di state election.

That one first make some pipo for di state dey paranoid as one APC Chieftain don dey spread before police catch am say na President Tinubu he blame while APC nor win for di state and him go make sure say to rule hard Govinor Yusuf for di state.

Before di APC National Chairman come reach di state dey beg for peace.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM