+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Court Sentence Bishop Feyi Daniels To Life Imprisonment For Rape

Di Sexual Offences and Domestic Violence Court wey dey for Ikeja Lagos state don give jorjimet about di founder, Bishop and pastor of I Reign Christian Ministry, Feyi Daniel, say make e go spend di rest of him life for prison for di church member wey di pastor rape.

Justice Ramon Oshodi wey jorji di case on Friday, January 26, say with all wetin hin don hear and see pastor Daniels really rape and sexually assaults of two of him female church members, so he nid to go prison for three years and still stay for inside prison for life.

Di judge say wetin di church members come complain plus di lady wey he rape and di one wey di pastor suck and press he breast  na really true and na only lie lie dey Daniel mouth.

But di case of say Daniel rape anoda pesin for he hass for 2020 di court troway that one for one side.

He say di resin na cus di lady nor fit proof say dem rape her or use force for her unlike the one wey show messages dey tell di pastor say she get infection afta di rape.

Naso judge Oshodi send pastor Daniel make he go dey stay Kirikiri prison where dem bin don hold am since before.

He come still say make dem go register di pastor name for di Lagos State Sex Offenders record.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM