+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Abeg Make Okuama Pipo Go Dem Village, N-Delta Leaders Beg Presido

Some senior men for Niger Delta don dey beg President Bola Tinubu make he show mercy so that di village pipo of Okuama wey run from dem hass fit go back to dem community, start dem life again.

Know say all di wahala dey come up afta di gbege wey dey between Okuama Urhobo village and Okoloba Ijaw village, wey come cus 16 sojas die.

Di trouble don pass two weeks and since di village pipo of Okuama run afta sojas burn dem village, fear nor make dem near there as everybodi don vamus komot.

But wey di Otota of Olomu Kingdom, Olorogun Albert Akpomudje dey tok about di mata, naso he dey roll beg President Tinubu say cus of say pikin use caca take stay bodi nor mean say di papa nor go karey am.

He say make Presido epp cus tok don dey fly say anoda gbege dey cook wey wan hapun for anoda Ijaw and Urhobo village.

Di Otota say e go beta if federal govimet put big power for king dem bodi to pass some kind jorjimet, cus with that one fear go dey for pipo bodi.

Also stretching an arm of plea to the President, Di foma Deputy Inspector General of Police, DIG Udom Ekpoudom come still dey beg from Akwa-Ibom State, say make govimet forgive and deal with cult problem cus na that one be one of di resin especially if dis young pipo don smoke higbo and shicha dem head nor dey tik straight again.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM