+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Togo Change System Of Govimet

Na new style of how di Govimet go dey run for Togo nai di lawmakers for di kontri don pass on Monday.

Di lawmakers say dem nor go dey do presidential kind of govimet again but na e go be parliamentary system.

Na 89 lawmakers nai vot for di bill and dem all agree say na dem go dey put president for position now and nor debate or public go shuk mouth put.

With dis new law di president go serve for only six years instead of the five years for two times wey one president for do.

Na only one mont remain for Togo to do election but e never dey clear if dis new rule wey dem bring so go hold ground for di next election.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM