+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Abuja, Lagos Center For Visa Application Nor Close — Canada

Where pipo take dey go apply for visa for Canada for Abuja and Lagos dey open for immigration, refugee and those wey wan do citizenship applications.

Na di Canadian High Commission for Nigeria nai dey open up for di mata for pipo to know how far.

On Monday fire burn for Canada Abuja office, generator house wey kill two pipo, then on Tuesday nai di embassy come say dem don suspend operation for dem office wey dey for Nigeria.

As many pipo for Nigeria wey dey wan apply for Canada visa hear di mata naso cold enta dem bodi about how to go.

But di new statement wey Canadian High Commission post for X through dem public affairs worker, Demilade Kosemani, say make pipo relax as dem office for Lagos and Abuna dey open for any vias application process.

“As e dey still pain us say two of awa workers die for Abuja High Commission of Canada, make you know dis one two.

“Immigration, Refugee and Citizenship Canada clients: we still dey process applications. Even with di suspension of operations for di High Commission of Canada for Abuja, di Visa Application Centers for Abuja and Lagos still dey open,” wetin Kosemani post.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM