+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Isreal AGree Nor To Bomb Gaza For 4 Hours

Israel don gree not to dey bomb northern Gaza strip every four hours everday.

Dis one dey come afta almost one month wey war start between Israeli military and Hamas militants.

Na di tokpesin of White House National Security Council, John Kirby nai make di announcement and he say dem go first announce am for three hours before dem go start di cease fir.

He say: “Israeli don tell us tok say dem military nor go enta dis area di time wey dem go do dis pause from today.”

Know say na for October 7 this year nai gbege take start between Israel military and Hamas one militant group wey dey for Palestine afta dem go bomb southern Israel.

Since di fight like 10,812 pipo from Palestine nai don die for Gaza Strip.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM