+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Afta 16 Years Super Falcons Make Am To 2024 Olympics

No be small shout of joy nai full pipo belle afta di Super Falcons of Nigeria break di 16 years delay wey don dey hold di women football team for years.

For inside Loftus Versfeld Stadium for South Africa nai Super Falcons take dash 1-0 to Bayana Bayana of South Africa to take quality di 2024 Olympics game wey go hapun for Paris.

Di match nor easy sha, but within 43 minutes nai Rasheedat Ajibade take score di penarity.

As dem Super Falcons enta di field naso Christy Ucheibe and Osinachi Ohale just dey make tins for soft for di team bifor mata come dey wan hard for di two team like old mama wrapper.

To say Nigeria nor win dem go shift go one side but naw dem go represent Africa for di 2024 Olympics game for Paris, France, from July 26 to August 11 2024.

Dis na di 4th time wey Nigeria dey qualify for Olympics game afta di last one wey dem get for 2008.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM