+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

EFCC Don Get Back N30bn From Betta Edu Investigation Case

Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC say dem don get fit return back N30 billion to do hakant of federal govimet base on di case wey dem dey investigate ontop di Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Betta Edu.

To folow up for di mata nai EFCC take tok dis one on Monday as dem bring out wetin dem don dey run for di agency, make public know about am.

If you remember say, Betta Edu and di foma CEO of National Social Investment Programme Authority, NSIPA, Halima Shehu nai EFCC deg investigate ontop say moni get kleg waka under dem nose.

Na teree months ago nai Presido Tinubu give EFCC go ahead to arrest and investigate Edu and Shehu base on say dem no fit cough out di million wey di agency dey find and dem nor know where e enta.

Pipo eye don dey for di case even as as some Nigerians dey cry say make dem allow Edu come back to office so that di office fit start to dey work again.

But now di chairmo of EFCC, Ola Olukoyede don say apart from di N30bn wey dem don get back, 50 bank hakant nai di agency still dey investigate to know how di moni waka pass.

Olukoyede say make pipo take am easy with di agency cus dem nor fit just give anyhow information, beta eye nai dem go put for ground so that di truth go come out, so make kontri men dem take am easy cus updat go dey drop anytime.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM