+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Again, NNPC Find Fake Refinery and Connections For Niger Delta

With di way crude oil production dey low for di oil and gas industry, e dey disturb do sector wey come make dem open eye wella to even dey see places wey crude take dey vamus from di kontri.

For one two minutes video wey Channels Television get on Wednesday, nai dem see where pipo dey tiff dis crude and na on di 10th and 16th of February nai e rale hapun.

Sum of dem na private companies and even govimet own join.

NNPCL still see like 20 illegal connection for Okirika Rivers State, Bayelsa State, and Delta State. Then fake refineries still dey for Rivers, Delta, Bayelsa, and Abia states.

For di video, different sacks of crude oil nai dem see for Warri, dem come seize sum for Edo State.

Di highest oil sack wey dem seize na for Olobiri and  Delta State.

Even for Ole, Ughelli and Warri motor wey di oil tiffs dem dem use NNPCL seize am.

According to NNPCL na 52 suspects nai dem don arrest now.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM