+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police arrest Labour party chairmo for Edo State

On Wednesday for Benin, nai di State police arrest di National Chairman of Labour Party, Julius Abure.

Abure bon enta Edo State cus of di govinorship primary of LP wey dem wan do on Friday.

With di way police take arrest Abure e come make many pipo protest go di Zone 5 headkwata of Benin Command.

But according to Tijani Momoh di resin wey make dem arrest Abure na base on petition wey pesin write against am, and na di Inspector General of Police nai say make dem go arrest am.

Momoh say dem give order make nor bodi see Abure cus video and recording dey wey di pesin wey karey case to police, show say dem beat am wey he come Hass last year.

He say di case wey dey Abure head na, hin try to wan kill pesin, karey gun and other bad tins. Investigation don start and any other tin dem go let world know.

Gis dey say before dis arrest yesterday, Abure and some members for LP inside Edo State don dey get some kwanta say he put some kind candidate wey nor suppose join di 2023 election but Abure say dem dey lie.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM