+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Akeredolu Transfer Power Give Hin Deputy

Governor, Oluwarotimi Akeredolu of Ondo State don las karey power put for hin Deputy, Lucky Aiyedatiwa, leg, as hin dey travel again for medical treatment wey go start from today, Wednesday, 13th December 2023.

On Tuesday nai di Govinor tokpesin, Richard Olatunde, say di deputy govinor nai go dey epp do di work of di govinor as e nor go dey around.

Olatunde say di governor dey go treat e sef so that he go strong wella before he come back to office.

“This letter to na to use am tell pipo say di govinor dey karey power put for e deputy hand just like qetin so Nigeria Constitution tok for di National Assembly.

“As Senior Advocate for Nigeria and pesin wey dem dey respect for Nigeria, Govinor Akeredolu dey always give power to e deputy any time he dey go for yearly vacation. E do am for April 1, 2021, April 1, 2022, April 3, 2023, and July 10, 2023, all those time wey he travel,” na wetin dey for di statement.

Govinor Akeredolu don bin dey for Ibadan, Oyo State,  since di last time wey he come back from medical trip from Germany.

As e come back nor stay for govimet House but pack go he won house for Ibadan, many pipo dey vex tok say make he give power to di deputy as do constitution for di kontri tok.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM