+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Bulldozer Don Bring Down Di Wall Of Rivers Assembly Complex

Di House of Assembly for Rivers State dey fall down like London bridge cus of so many gbege wey don enta di state.

On Wednesday morning bulldozers just full everywhere as dem start to scatter di building with dem big moto.

Dis one na before di leader of di house wey some pipo nor want, Speaker, Edison Ehie, karey some other lawmakers wey loyal to Govinor Fubara, go do meeting early early morning today.

All dis wahala dey come afta High Court for di state say na Govinor Siminalayi Fubara loyalist, Ehie nai be di speaker of di House till dem go judge di case finish.

Just Monday here, na out of di 32 lawmakers wey dey di House, 27 wey loyal to foma Govinor Nyesome Wike komot from PDP go join APC, come dey make di fracas wey dey between Fubara and Wike dey worst.

Wetin tori tok sha be say, as di lawmakers dem sitdon dey tok nai Speaker Ehie say dem wan repair di complex cus of di fire wey burn am for October 30, 2023.

But di state Govinor don give dem anoda place make dem take run sitting and dem don even start to dey go through di 2024 budget of di state.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM