+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NAFDAC Close 250 Fake Drinks Shops For Aba, Arrest 10

E pass more that 250 shops for Eziukwu Road Market inside Aba for Abia State wey National Agency for Food and Drug Administration (NAFDAC) don close as dem dey do operation against fake products and pipo wey dey produce am.

On Monday 11, nai dem start di raiding then on Tuesday 12, dem close over 250 shops and arrest 10 pipo wey dey produce fake tins like wine, spirit drink, and different kind of tea.

As di NAFDAC director for South East region, Martins Iluyomade dey tok to tori pipo on Tuesday, December 12, 2023, say dem go close di Eziukwu Road market so that their work go easy.

“We don write go give Abia State govimet say we wan close di road until di operation finish.

Ilyomade say, “We want were cool for awa operation to go well.

Cus of how NAFDAC start di operation, concerned society group, for South-East say e go beta make dem put very strong law against pipo wey dey di fake drinks and prodicts for inside di kontri.

Charles Chinekezi and Comrade Goodluck Ibem, Chairman of Civil Liberties Organization, CLO, Aba Unit and President-General Coalition of South East Youths Leaders, COSEYL say e go beta make national assembly put death sentence give any pesin wey dem catch dey do or sell fake products.

Dem say wetin dis fake pipo dey do na big crime against human being life.

“Dem just dey kip kwayet kill millions of pipo plus pikin wey dey belle. Many women wey get belle dey buy all dis fake products dey drink and naso e still dey go touch di baby,” na wetin Prof Chinekezi and Comrade Ibem.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM