+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

All Govimet Worker Must Exercise, Uganda Govimet

Uganda Govimet don say na must for every pesin wey dey work with govimet for di kontri to dey do exercise afta dem get know say di way pipo take dey fat out of control too much for dem nation.

Di Govimet nai send Lucy Nakyobe make de drop di update give all agencies say make dem civil servants dey do two hours exercise every week, as dem nor wan hear kpregede ontop pesin life.

The Govimet own be say make dem reduce di way life style disease take dey increase for di kontri nai be dem own.

Even Dr Charles Oyoo Akiya, wey be di health Minister for non communicable disease prevention, say dem like di new idea die, as e go helep plenty pipo.

For dem wey be ministry dem don already dey do excerice and dey pray make all departments dey do am, so as Govimet don give stamp order, na di best for everybodi.

Bifor naw, Uganda don bin do one special day for 2018 make dem use take do sports for di kontri.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM