+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Bandits Fit Contribute To Di Kontri – Foma Minister

Foma Minister of Communication, Adebayo Shittu wey dey work with foma President Buhari don tell President Bola Tinubu say make dem do peace tok with bandits to end all dis too much kasala and gbege wey dey hapun for North.

Shittu say many of all dis bandits dem get brain to bring beta tin for di kontri.

Na wey hin dey tok for Channels TV nao he take say bandits dem be able bodi pipo a d of dem get di chance dem go kotribute to di betament of di kontri for gud.

Shittu come say di resin wey make bandits plenty for North na sake of say many of di children there nor dey go skool again.

You go remember say Ahmad Gumi, one Islamic preacher don dey tell President Tinubu say make e nor follow di road of foma President Buhari, but instead tok with bandits to know wetin dem want.

Di tok of Gumi sef don make federal govimet call am to come do some kwestun and ansa of di rope wey tie am to bandit.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM