Di way wey some bad pipo dey use karey girls go do some kind hustle wey nor make semse for neighboring kontri just dey get worst everyday and dat na di kase of one girl wey be Annabel.
Annabel na 19 years girl from Delta State wey pesin decive go Côte d’Ivoire onto say dem go give her beta work but na anoda tin nai she see wey she reach there.
Naso she come dey find how to come back cus di work wey dem tell her no be so but with di epp of Hon. Stella Okotete, Annabel don come back afta plenty months for Ivory Coast.
Nai make di update come dey important cus di lie don too much for young girls wey nor know and dey find how dem go fit japa go beta kontri for beta life but di end result na olosho work nai dis bad pipo dey push dem enta.
