+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Uzodimma Give Us Awa Land, Owerri Women Cry

Women wey dey for Umuejechi Nekede for Imo State don pull dress dey protest say make Imo State govimet give dem back their great grand papaland.

Di women enta road dey sing with pain and karey different card with wetin dem write, ‘Gov Uzodimma na dis land be di only tin wey awa papa leave for us, Uzodimma you nor fit purshu like say ae be slave, we still get right.’

Wey di Assistant Woman Leader for Ndom Umuejechi community dey tok to tori pipo, Dr. Mrs. Regina Emereonye, say gbege go happen if dem nor gree folow di rule of law.

Wetin Emereonye tok to tori pipo: “We nor dey like find trouble for awa community, but make pesin nor luk us like say we be mumu and nor know wetin to do.

“Wahala nor be anybodi friend but if dem nor folow wetin law tok then na gbege go end am.

“Di land wey dem dey tok about so, na awa grand papa dem nai get am. Dem give am to di foma Eastern Region Govimet before civil war, make dem use am do agricultural work.

“Since di State Zoological Garden and Wildlife Park, wey bin dey bring moni nor dey function again, dem suppose return di land to di original pipo wey get am with wetin court tok.”

Court bin don tell di state to return di land and di community tru dem lawyer Mr. U. B. O. Obinna, don send letter go give Govinor Hope Uzodimma, say make he nor dey use di land for Agriculture Development Corporation again as e kukuma nor dey work.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM