As some pipo don dey blast Innocent Idibia, 2face as hin don really show he other face to him wife, Annie Idibia wey dey act film, say dem marriage nor fit work again. Popular media person wey dey put mouth for everybodi problem, Daddy Freeze don solve one maths for di problem as he open up about di new woman wey 2face dey friend. Noise start for social media on Sunday wey 2Baba go write for Instagram say he don seperate from Annie and dem go soon divorce after 12 years of marriage. As pipo hear di news, see provocation from every cona but Daddy Freeze don use style take tok di new woman wey 2face dey follow, say na one honorable member. Normally Daddy Freeze, dey close to Annie and 2face and he say Annie know say di singer bodi nor dey fit stay with woman but she karey leg still enta marriage with am, so make she dance di song wey di radio dey play.
US:Justice department sack 12 officials wen work on trump criminal case
Report say the United States’ justice department don sack more than 12 officials when work on the criminal investigations wen concern President Donald Trump. Officials from the department confirm am give the CBS on Monday say the prosecutors receive the sack letters of appointment from James McHenry, acting attorney general, thru email. According to the officials, Henry tell the prosecutors say dem no go fit “trust dem to “faithfully” implement Trump agenda.
NAFDAC close market for Aba
The National Agency for Food and Drug Administration and Control NAFDAC don shut down the Cemetery Market for Aba, Abia State, for the second time for inside two years. The agency say dem discover and den seize fake and substandard food and beverages wen worth more than ₦5 billion for their latest operation wen dem tag Operation Clean Up Aba. When NAFDAC Director-General, Prof Mojisola Adeyeye, come dey yarn for inside one statement wen she sign on Tuesday, he come talk say the raid na “the most decisive action for the history of the market.”
45 percent of Naija girls dey born before 18 years – World Bank
The World Bank don talk say 45 per cent of girls for Nigeria dey give birth before the age of 18. Na the World Bank Country Director, Ndiame Diop nia drop dis update for the National Conference on Girls’ Education and Empowerment wen hold for Abuja on Tuesday. Wen Diop wen the World Bank Deputy Country Director, Taimur Samad represent yarn for the conference wen dem tag “Effective Partnership on Girls’ Education: Out-of-School Children Education for National Development,” he come talk say “more than two-thirds of girls for Nigeria dey drop out of school before junior secondary school.
Akwa-Ibom Deputy Govinor Pikin Don Die
Tears don hapun for Akwa-Ibom State again just few months afta Govinor Umo Eno wife die, di Deputy Govinor, Akin Eyakenyi don dey cry too as her daughter don die too. Tori get am say di deputy pikin wey be Blessing dey born for hospital for Port Harcourt wey problem come start nai lead to her kpeme. Govimet officials, politicians and different pipo don dey tell di family sorry. Di bad tin be say Blessing just marry seven months ago bifor she come dey die so.
Trump don sign to end homo for US military
US President Donald Trump on Monday sign one executive order wen go end wetin he call “transgender ideology” from the military, and dis move so dey mark one ogbonge step back for LGBTQ rights. During different military kind of announcements for Air Force One, Trump come still call for the development of one US equivalent of Israel Iron Dome missile defence system. The executive orders come reinstate service members wen dem sack becos dem no gree take the COVID-19 vaccine and den expand efforts to end diversity programmes within the armed forces.
I Go Tell My Lawyers To Komot Court Case Against Dele Farotimi – Afe Babalola
Di upandan wahala wey dey between Afe Babalola and lawyer Dele Farotimi wey dey like do activist work, be like wetin go soon end. Remeber say Babalola karey Farotimi go court say, book wey di activist write dey talk bad about am and Magistrate Court for Ado Ekiti to punish am but now he don change mind to komot mata from court. Na afta di Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi, go visit Babalola on Sunday nite for hin house join with other traditional rulers. Wey dem dey tok nai Babalola say many pipo even foma presidents don beg am and so he nor get choice but to listen to everybodi. He say e nor get anytin wey he wan gain if Farotimi go stay for prison so him go tell him lawyers make dem komot di case from court.
EFCC Nor Wan Arrest Ezee Concept Again
As quiet fight dey go on between gospel singer, Mercy Chinwo and Music Manager, Ezekiel ThankGod Onyedikachukwu, wey everybodi know as Ezee Concept sotay dem come even use Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) put for di mata, dem don close mata for arrest. Na on Friday for Federal High Court for Lagos nai dem take cancel arrest mata against Ezee Concept afta di petition wey EFCC don already karey go meet court. Naso lawyer Bilikisu Buhari wey be EFCC lawyer tell di judge, Justice Alexander Owoeye say dem dem nor want that part again. EFCC don bin dey try to arrest Onyedikachukwu cus of say he nor use $345,000 of moni wey come out from di music well and even di songs of Chinwo dey online, she nor know how e dey waka pass. Di fight come dey hapun between di singer and manager since, wey di singer say she nor know how moni dey waka pass.
Nigeria Pipo Nuba 1 Bleaching Cream User Worldwide, Health Minister
Dem don karey first position give Nigeria for bleaching cream wey men and women dey use and di govimet don dey try to make sure say dem tok to pipo about di danger of bleaching cream to make pipo stop. For one regional awareness-raising workshop to komot lightening cosmetics products, wey Minister of State for Health and Social Welfare, Dr Iziaq Salako, take tok for Gabon, nai he take dey urge West African pipo to know di bad tin wey products wey get hydroquinone, mercury and other tins dey do for pipo bodi even cus cancer, skin problem and damage pesin organ. But on Wednesday for Abuja, Dr. Salako, bodi come dey pepper am as he say pipo go even see wetin dem write put for those creams, ointments, soap, pills and injections but dem nor go still hear, dem go karey dey use especially women wey wan show dem men. He come say Nigeria don dey do National Policy for Cosmetics to make sure say pipo wey dey wan use cosmetic products dey safe from all dis bad tins wey dey cus sicknes and disease for users life.
We go deal with Naira buying and selling – CBN
Governor of the Central Bank of Nigeria (CBN), Dr. Olayemi Cardoso, don promise to tackle the buying and selling of Naira notes, wen don trun something else for the country. CBN Governor, Mr. Olayemi Cardoso make d promise for one keynote address during the inaugural Stakeholders’ Conference of the Committee of Heads of Banks Operations (CHBO) for Lagos, with the theme “Commoditization of Naira: The Way Forward.” Cardoso wen the Senior Special Adviser to the CBN Governor, Fatai Kareem represent come talk say dis buying and selling of the Naira dey pose serious threat not only to the banking sector but also to the daily lives of Nigerians when dey rely on the currency for transactions.