The ruling All Progressives Congress, APC don extend their ongoing nationwide membership registration by three weeks so dat dem go fit capture more intending members. The registration and update of their membership register begin on Tuesday 9th February, 2021 across the 36 states of the federation and e suppose last for two weeks. But wen National Seceto of the Caretaker Extraordinary Convention Planning Committee CECPC of the party, Sen. John James Akpanudoedehe come dey yarn for one statement on Sunday for Abuja, he come talk say the feedback across the states na blast, say d turnout massive, say e pass wetin d party been dey expect.
No sit down house, cast your votes-Onoyake
Ahead of the March 6th local government elections for Delta State, Uvwie LG chairmanship Candidate of the Peoples Democratic Party PDP Ramson Onoyake don tell people wen dey long side for d state and indigenes say make dem no sit down for house o, make dem gather come out come cast their votes. Wen Onoyake dey yarn during one interview for Effurun, he come talk say na the local government nia be the closest to the grassroot, den he come talk say electing the right individuals go go a long way to bring better growth come the grassroot. He come still promise to improve the education sector for the LGA d more, den he say he go do more skill training and acquisition programs.
College of Education students protest for Warri
Students of college of education for warri protest on Thursday against d alleged intimidation and oppression wen dem say dem dey receive from of management of the kians wen the provost Prof Mary Onire Edema dey lead. The protesters when run one peaceful go crown and Kpoko FM office for along airport road come talk say some of the final year students neva still see their 100 level results, den dem come still complain about d increment of school fees without any formal notice. The students come still talk say mago mago dey for the result wen dem get from their department and the ones wen d scholl display online. Wen the school come dey react through their talk talk person, Vusi Enakarire, he come talk say d allegations no be true, he say d students neva see their result because them neva pay their school fees and so dem no go fit get access to d school online portal. Den concerning the issue of increment for fees, Ms Enakarire, he come talk sagy wetin the students describe as increment for the school fees na the 5, 500 penalty wen dem dey tender for late payment and registration.
Use youths wen no get work take join this fight-Sani Musa
Sani Musa, d senator wen dey represent Niger east don tell security agencies to take advantage of Naija unemployed youth population to assist for d gbege against banditry. Wen Musa dey yarn concerning d way wen bad guys take kidnap students, staff and family members yesterday from Government Science College for Kagara, Niger state, he come talk say governments for across all levels need to put in more efforts to improve security. The senator come talk say na the duty of the armed forces to find the location of bandits and den flush them out.
We no support this tribal targeting tin-NGF
The Nigeria Governors Forum (NGF) don talk say dem dey against the targeting of citizens on the basis of their tribe. Wen Kayode Fayemi, chairmo of the forum dey yarn on Wednesday after one emergency meeting for the state house for Abuja, he come talk say governors get the strong feeling say if the National Livestock Transformation Plan (NLTP) dey strengthened, e go address the herder-farmer gbege. The matter na say tension don dey increase for the country becos of some herdsmen wen dey involve for kidnapping and banditry.
Defend yourself: Minister of Defence yarn give Nigerians
The Federal Government don tell Nigerians to defend themselves against bandits, kidnappers and other criminals for across the country. Na the Minister of Defence, Major General Bashir Magashi nia yarn dis one for one interview wen he get with news people for the House of Representatives, after the screening of the new service chiefs. When dem come ask am if civilians go fit dey allowed to carry firearms to protect themselves, the minister come talk say he no go advice Nigerians to use firearms for internal use.
Delta State: Man stab brother wen com settle marriage gbege die
One Mr. Daniel Agbayigolo younger brother don stab am die for Ughoton community for Okpe Local Government Area of Delta State. According to reports, Mr. Agbayigolo go settle quanta between him younger brother and the wife on Monday wen the okamuka take happen and dis one so come make the community dey mourn. The state Police Public Relations Officer, DSP Onome Onovwakpoyeya wen confirm d matter on Wednesday, come talk say d suspect don shock in.
No dey hide fuel-DPR dey warn
The Department of Petroleum Resources, DPR, don warn depot owners say make dem no dey hide petroleum products for their facilities. Na Mr. Sarki Auwalu, d Director of DPR nia give the warning for one statement wen he drop on Wednesday for Lagos. Auwalu come talk say he get to give the warning becos of d reports wen dem dey receive say some depot owners don create artificial scarcity unto say dem dey hide products for some parts of the country.
Job creation nai go make us succeed-Okonjo-Iweala
Ngozi Okonjo-Iweala, director-general of World Trade Organisation (WTO) don talk say Africa go only succeed wen dem create jobs for the youth. Wen Okonjo-Iweala dey give her opening speech for the 2021 Lagos ‘Ehingbeti’ Economic Summit, she come talk say the issue of unemployment na very big issue among African countries, and she say dis one dey affect the continent at large. Meanwhile, for one separate interview, as d director-general of WTO dey appreciate Nigerians for d way wen dem take support her, she come talk say she go work hard to justify the confidence wen d people put in her so as to create more opportunities for other Nigerians and Africans in general.
We need to put family planning laws-Sanusi
Muhammadu Sanusi II, the before before emir of Kano don talk say need dey to put strict family planning laws. Wen Sanusi dey yarn on Wednesday for the ongoing Ehingbetti Economic Summit, he come talk say the government no go fit keep up with the pace of improving social infrastructure if people continue to dey born children wen dem no go fit feed and send go school. He come still tell the federal government to raise awareness on child nutrition, not just the current school feeding programme.