The first half penalty wen Jorginho score on Thursday nia help Chelsea beat Tottenham 1 kondo as Thomas Tuchel win him first game for the road wen he take dey in charge of the Blues. The Italy playmaker convert d goal from the spot after 24 minutes after Eric Dier play Timo Werner rough for the critical moment of the match.
We no go sponsor pilgrimage again-Ekiti state government
The Ekiti state government don talk say dem no go dey sponsor pilgrimages to Mecca and Jerusalem again. Bisi Egbeyemi, the deputy governor, say the development dey in line with the federal government decision to end sponsorship of pilgrims, so dat dem go fit save pepper for development purposes. Egbeyemi come tell those wen dey interested to visit Mecca and Jerusalem for pilgrimage say make dem look for private sponsorship.
Make una come back to the north-NEF yarn give herdsmen
Northern Elders Forum (NEF) don tell herdsmen say make dem return to the northern region if their security no dey guaranteed for their host communities for the southern part of the country. Wen NEF Director of Publicity and Advocacy, Hakeem Baba-Ahmed dey yarn for one statement, he come talk say dem decide to advice their people to relocate becos of d alleged attack on herders, families and communities for some states wen dey for the south. NEF come still tell northern Governors to start preparation to receive the Fulani communities wen people dey pursue comot from southern states.
To gbab the badoo herdsmen be our concern-Ikpeazu
Chairmo of the South East governors’ forum and Abia state governor, Okezie Ikpeazu don talk say the south only dey interested in gbabbing all d badoo dem wen dey use d title of herdsmen take dey commit crimes. This week, South east governors say na to ban open grazing nia be d koko. Wen Ikpeazu come dey yarn during one interview on Wednesday, he come talk say those wen dey raise up d issue of tribe dey try to draw people attention comot from the security threat. He come talk say need dey for uniform approach to take deal with suspected criminals not minding their ethnic background.
Ex-service chiefs no march line -Lai Mohammed
Lai Mohammed, d minister on top information and culture don talk say d people wen dey say make the International Criminal Court (ICC) probe before before service chiefs for The Hague no dey patriotic. Some civil society organisations (CSOs) don file complaints against the former service chiefs, particularly against Tukur Buratai, d before before army chief for the ICC. Different complains don come about the way Buratai, Gabriel Olonisakin, former Chief of Defence staff; Ibok Ibas, former Chief of Naval staff; Sadique Abubakar, ex-chief of Air staff; take run the affairs of the military. But Mohammed dey say the past service chiefs no march line at all at all.
Naija need money to get Covid-19 vaccine -Peter Obi
Peter Obi, before before governor of Anambra don talk say Naija need more than N150 billion to take get COVID-19 vaccines. You go remember say Osagie Ehanire, d minister of health, yarn for d month of December 2020 say the federal government need about N400 billion to take get COVID-19 vaccines. According to Ehanire, d federal government go need N400 billion to take vaccinate 70 percent of Naija population wen pass 200 million, at $8 per person. But wen Obi come dey yarn on top the matter on Tuesday, he come talk say he dey concerned about transparency as regards the getting of d vaccines. He come still tell the government to revive the National Vaccine production center wen dey for Yaba for Lagos state to cater for the country vaccine needs.
Buhari dey work on the farmer-herdsman gbege for Naija
Special Adviser to the President on top Media and Publicity, Femi Adesina don talk say the herders and famers gbege really dey much for the current administration. Adesina when yarn for one interview on Monday come talk say while dis quanta don dey between both sides for many the years now, he say d misunderstanding increase for d last few years. He come talk say the administration of president Muhammadu Buhari don already dey work on how to get lasting solution to dis matter.
Liverpool don complete loan deal for Ozan Kabak
Liverpool don complete one loan deal for Schalke Turkey central defender Ozan Kabak. The 20-year-old go dey wit the Reds until the end of the season, with the club wen don still sign Preston North End Ben Davies for £2m. Meanwhile, defender Davies wen be 25 years don sign one “long-term” deal.
Kpoko FM: Celebrate 5 years baiday, win oil-city award
As the empowerment station for Deltans kpoko100.5fm dey celebrate their five years anniversary , the station don win the 2020 oil city advancement awards as the radio station of the year. The award show dis past weekend and na for Bon hotel Warri nia d event for take shele. For the number of years wen kpoko100.5fm don dey exist, dem touch lives and na so e don empower plenty people too with their ogbonge programs.
NECO don announce new date for external SSCE
The National Examinations Council (NECO) don announce one new date for the 2020 SSCE External examinations. NECO drop dis informate for one press statement wen their talk talk person Azeez Sanni sign on Tuesday. The examinations, wen suppose start on February 1 to end on March 3, go come start now on February 8 and den end on March 10.