Foma Govinor of Anambra State, Peter Obi don go visit Dele Farotimi, lawyer wey dey do activist work join as dem arrest am come out am for prison say he dey tok bad against Nigeria judicial system and even curse pesin for he book. On Monday evening nai Obi come still karey hinsef go meet di founder of Afe Babalola University for Ado-Ekiti (ABUAD), Aare Afe Babalola, SAN, for hin office wey dey inside di skool. Normally Farotimi na very strong member of Obidient movement bifor dem arrest am come charge am to magistrate court for Ado-Ekiti last week. Sources say di resin wey make Obi go visit Babalola na cus of Farotimi do that dem fit end di case and na thru one foma Presido nai Obi fit take get di link to see Aare Afe. Court sha don give Farotimi bail of N50m and he go bring pesin wey get reach N50m to stand for am, na those tins he lawyers dey work on.
We don ban sachet alcohol,obey am -NAFDAC
Mojisola Adeyeye, director-general of the National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC), don tell manufacturers and distributors to obey the ban on alcohol for sachets and PET bottles. Wen Adeyeye dey yarn during one session for the NAN Forum wen hold for Abuja on Sunday,she come hammer on the ban and the agreement wen the Distillers and Blenders Association of Nigeria sign. Na for the year 2018, nia NAFDAC for take ban the sale of alcoholic beverages for sachets and PET bottles wen dey smaller than 200ml for Nigeria.
IPMAN don start to dey get petrol from Dangote
Report say the Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria IPMAN don start to dey lift petrol from the Dangote Petroleum Refinery. This one dey happen after IPMAN reach agreement with the refinery last month. News people say so far, IPMAN members don lift millions of litres of petrol from the Dangote refinery wen dey for the Lekki free trade zone for Lagos. The National Publicity Secretary of IPMAN, Chinedu Ukadike wen confirm d matter during one interview with news people come talk say the lifting of petrol from the Dangote refinery start for late November.
No force your pikin do training – Mbappé
‘Project Mbappe’ don become one popular word among football parents wen love football wen go like make their children follow the footsteps of Real Madrid striker Kylian Mbappe. E no really dey surprising, becos of the extraordinary success wen the 25-year-old don achieve based on say he don win one World Cup, seven Ligue 1 titles, finish as runner-up for the Champions League, and seven Ballon d’Or nominations. However, Mbappé don warn parents say make dem no force children dey demand for training so dat dem go be the next football icon.
Magistrate court give Dele Farotimi bail
One Ekiti State Magistrate Court don grant human rights lawyer Dele Farotimi bail for one defamation case wen Afe Babalola file. The 2023 African Action Congress (AAC) presidential candidate, Omoyele Sowore, announce the development for him X handle on Monday. Sowore come talk say d court grant Farotimi N50m bail with surety for the same amount, when must provide landed property as collateral and then d court come adjourn d case till 29 January 2025.
Free Awa Leaders Or Una Go See Serious Gbege, Okuama Community Tell FG, Military
As di President-General of Okuama community, Pa James Oghoroko don die afta army catch him and five others go lock for where no bodi know since August 18 and 20 sotay di PG come die there, di pipo don dey do protest to ask for justice. Na on Sunday nai dem start am, though say dem nor karey wahala do am but di pipo belle nor sweet as dem dey vex di way army dey do dem. Cus of am, dem give govimet and army 7 days to behave well and bring dem leaders and release di deadi bodi of dem PG or face di problem. Dem say di community pipo go block River Niger if di 7 days finish cus dem too na humans wey need beta treatment from President Bola Tinubu and Nigeria Army.
Many Road Block For Onitsha-Enugu Express Road Nor Good — Reps
House of Representatives memebers mind don dey disturb dem about di way wey security agencies take dey colet moni from motor drivers hand for Onitsha-Enugu express road and di too many checkpoints. Na Hon Amobi Oga nai bring di mata up on Thursday wey dem dey do meeting and naso di House members gree with am say dem get to tok with security pipo to look for anoda way. Di lawmakers come say make all di security operatives gada to geda to make sure say all di suffa and way of treating pipo for that side stop cus di too much road block dey stop growth and for di region. Nai dem tell di joint Committees on Defence, Army and Police Affairs to tok with Service Chiefs and di Inspector General of Police to make sure say dem look for way to reduce di sufaness wey dey for Onitsha-Enugu express road.
Max Air Plane Engine Catch Fire, Borno Deputy Others Safe
Passengers wey enta Max Air airoplane around 7 on Wednesday evening to take go Abuja nai see oba afta one of di airoplane engine catch fire as he just start to fly cus one bird fly enta. 100 pipo nai dey di plane join di Deputy Govinor of Borno State, Alhaji Umar Usman Kadafur, but dem happy say no bodi die for di Maiduguri International Airport. As di plane do emergency landing cus of di fire, some pipo say dem go again, carry dem bag go house while others join with di deputy travel to Abuja with anoda plane wey Max Air management give dem.
Court Send Activist Lawyer Farotimi To Stay For Prison
Afta Nigerian Police don arrest human rights lawyer and activist Dele Farotimi come even put am for prison say he write against Aare Afe Babalola (SAN) for him book Nigeria and e tiff man Justice System. Na di presiding Magistrate Abayomi Adeosun for Ado-Ekiti, Ekiti State, nai say Farotimi go dey for prison until December 10. Di 16-count charges wey dem put for di lawyer head na police prosecutor, Samson Osun, nai stand put and dem say Farotimi go dey there till afta investigation, but di lawyer still stand say he nor guilty. Do Lawyer of Farotimi say he client not dey guoth and di case na sumtin wey dem got bail until investigation show say he really do am but di court nor gree, say make Farotimi dey prison till December 10.
Namibia Vote Woman To Be President, First Time Ever
Afta dem don get break away from South Africa for 1990, Namibia don vote 72 years Netumbo Nandi-Ndaitwah to be di kontri first woman president since dem history. Di kontri wey dey very rich for mineral nai vote Nandi-Ndaitwah wey be di Vice President bifor under South West Africa People’s Organization, SWAPO, party wey don dey rule di kontri for long now. Her win push Panduleni Itula di presidential candidate of di opposition party Independent Patriots for Change, IPC, go one side with 57 percent vote. On Tuesday nai di election authority announce say na di VP nai win di November 27 election even with all di tins wey hapun.