D Minister on top Labour and Employment, Dr. Chris Ngige don talk say the federal government go arrange one new committee wen go start fresh negotiations for full implementation of the new national minimum wage. Mr. Ngige yarn dis one when the leadership of the Nigeria Labour Congress go visit am for Abuja. He come talk say e dey important for workers wen dey earn above N30, 000 wen dey for grade level seven to 17 to dey patient even as dem dey make adjustment on top the minimum wage implementation.
Senator Dino Melaye say division dey Nigeria
As Nigerians dey prepare for Naija 59 years independent anniversary, federal lawmaker Senator Dino Melaye don complain say division dey for the country, he come say make d lawmakers tackle d matter. Wen Melaye dey yarn for the floor of the red chamber for Abuja, he come talk say the country dey divided along ethnic and religious lines. He come las las talk say e go hard to achieve better result for d country wen we desire if we no dey united
Mad melon from Danfo Driver music group don kpai
Nigerian Reggae singer wen dem dey call Omeofa Oghene, alias “Mad Melon” wen be from the popular Danfo Driver music group wen still get Mountain Black as member, don kpeff for one hospital for Lagos state after he battle wit sickness. Na ogbonge singer and social activist, Daddy Showkey nia make dis announcement for him Instagram page today. The group become popular for the early 2000s for their unique music style wen Nigerians still dey feel till now.
FG don declare October 1st as public holiday
The Nigerian government don declare on Tuesday wen be October 1st as public holiday to take mark Naija 59 years Independence Anniversary. This informate dey for one statement wen the Permanent Seceto Georgina Ehuriah sign. The Minister on top Interior, Rauf Aregbesola, when make d announcement on behalf of the federal government, come congratulate Nigerians wen dey for Naija and even d ones wen dey for abroad even as we dey mark this year anniversary, he come tell dem say d government dey committed to end the current insecurity matter wen dey play for the country. Mr. Aregbesola come talk say peace and stability na compulsory for the development of any nation.
Heavy-weight clash for the carabao cup next round
Four big boys for the English league cup go jam each other for the fourth round unto say Chelsea go play against host Manchester United, while Arsenal go come jam Liverpool. Chelsea go play d game wit their life based on say Manchester united don first kpokpo dem 4 kondo wen dem meet for Old Trafford for the opening day of the season, while Liverpool go try to extend their nine-game unbeaten run against Arsenal.
Register with NIMC to get identification number
The Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) don advise candidates wen dey wish to write the 2020 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) say make dem register with the National Identity Management Commission (NIMC) so dat dem go fit get the National Identification Number (NIN). The board say the NIN go be compulsory something for UTME registration next year. He come talk say na only candidates wen get NIN nia dem go allow write for the exam next year. JAMB say dem no go dey capture the biometrics of candidates again becos dem go upload d information wen d board require from the data wen the NIMC capture for registration.
FG don spend 1.5 Trillion For Power Sector
Vice-Presido Prof. Yemi Osinbajo don talk say the federal government don spend N1.5 trillion for the power sector for the past two years. For the month of July, the vice-presido say the administration don pump N900 billion for the sector since wen dem enter office for d year 2015. For the month of August, the federal government approve another N600 billion intervention fund for the sector. Wen Osinbajo come dey yarn for the Kainji hydro power plant for Niger state, he come talk say the government dey put policy reforms in place wen go guarantee access to electricity wen go dey affordable for Nigerians.
Carabao cup update
Arsenal hammer Nottingham Forest 5 kondo for the Carabao cup game wen dem play for the Emirate stadium. Gabriel Martinelli down two goals, Rob Holding, Joe Willock Reiss Nelson come drop one one each wen make d game end for 5 kpoyon Like dis Arsenal don rotate enter the next round of the league For another side Manchester City knack Preston Northend 3 kondo
Enyeama must prove himself before he come back
Super Eagles goalkeeper trainer, Alloy Agu, don talk say Vincent Enyeama must prove say he sabi still keep, if he one rotate enter back the super eagles team. Enyeama be talk for one interview say he fit return back to the super eagles based on say he never play for the country for two years after him be retire. But for Agu, he believe say na him performance go help am get ehn shirt back for the post for the national team The super eagles go play brazil for one friendly for the 13th of October but nobody never know if Nigeria coach genort rohr go call before before captain make him join the team
Physically challenged go soon receive money
The Delta State Bursary and Scholarship Board say dem go soon start to dey pay 2018/2019 Scholarship dey give the Physically Challenged and Children of Civil Servants wen don kpai. For one statement wen d Executive Seceto of the Board Orishedere Sunny sign, payment go start on d 30th of September, 2019. Sunny come say make those wen go benefit from the level dey at alert and say dem fit fire down go the Board Headquarters wen dey for along Anwai road, Asaba , Delta State for more information.