Manchester United prove yesterday say their recovery under Ole Gunnar Solskjaer na follow come unto say na Marcus Rashford nia down d goal wen dem take beat Tottenham 1 kondo. The two sides hold their side strong wit enof chances but United goalee David de Gea prove the difference unto say he make correct correct make sense saves. United present manago Solskjaer put Rashford as him number one striker and true true he see d result unto say na the 21-year – old nia score the only goal of d game for the 44th minute.
Naija must survive
The Vice Presidential Candidate of the Peoples Democratic Party, Mr. Peter Obi , don talk say the 2019 elections na all about the survival of Naija. Obi yarn dis one yesterday for one interview wen he get with news people for Amichi for Nnewi South Local Government Area of Anambra wen he dey talk on the state of the nation under the three-and- half – year rule of the All Progressives Congress APC. According to am, President Buhari don show say he no go fit rule d country, he come talk say example of wetin he dey talk na d plenty economic and security challenges wen dey face Naija since wen the APC administration start.
PDP dey support corruption
The All Progressives Congress (APC) say the Peoples Democratic Party (PDP) dey support corruption. The ruling party yarn dis one wen dem dey react to one statement wen the PDP make. The opposition party talk say the allegations wen dey against Walter Onnoghen, chief justice of Nigeria (CJN), na move wen the APC government wan take cause constitutional crisis” and den put fear for judicial officers their body so dat dem go do wetin dem want. But wen Lanre Issa-Onilu, APC spokesman dey yarn yesterday, he come talk say the gbege against corruption remain one of d main promises wen him party make give Nigerians.
Forbes Report
Aliko Dangote na Africa richest man for the eighth time back to back — although him wealth drop by $2 billion from $12.2 billion for January 2018 go $10 billion for 2019. This one na according to Forbes’ Africa Billionaires List wen dem release yesterday. Mike Adenuga, d chief executive officer of Globacom with interests for oil exploration and real estate come move go up to be Africa second richest man. The American magazine come talk say Adenuga net worth increase anyhow from $5.3 billion go $9.2 billion.
I go industralize Nigeria
Obiageli Ezekwesili, the presidential candidate of the Allied Congress Party of Nigeria (ACPN), don promise say she go industrialize Naija if she dey elected for d year 2019. She say she go encourage marketers and entrepreneurs to achieve dis one. Mrs. Ezekwesili make the promise when she dey launch her campaign for the Mararaba and Nyanya markets for the FCT yesterday. According to her, ACPN dey positioned to promote economic and educational policies wen go better the lives of ordinary Nigerians, especially the marketers and entrepreneurs.
Nobody go use government money for campaign
President Muhammadu Buhari don talk say he no go gree make anybody use government money for campaign. According to Garba Shehu, presidential spokesman, oga presido make the statement wen dem dey close the federal executive council (FEC) for Abuja. Oga Buhari come tell cabinet ministers say make dem take advantage of technology take reach out to voters on the need for why the All Progressives Congress (APC) need to return for next month general election.
Chelsea wan buy higuain
Chelsea don senior up for their efforts to bring Gonzalo Higuain to the club for the remaining part of the season. Maurizio Sarri dey urge for strikers and him search come increase d more after Tottenham wire Chelsea 1 kondo for d Carabao Cup semi-final game wen dem play yesterday night. He don manage the Argentine striker Higuain before for Napoli and if dem meet again everything go go well but for now dem neva agree on any deal yet.
Military don release Abubakar
Our military don release Uthman Abubakar, north-east regional editor of Daily Trust Newspaper. Na Mannir Dan-Ali, editor-in-chief of the newspaper nia announce the release after he receive Abubakar wen one army officer carry enter the Maiduguri office. On Sunday, soldiers ball enter the head office of the newspaper for Abuja and their regional offices for Maiduguri, Borno state capital, and Lagos.
We Must Arrest You
The Police authorities don promise say dem no go lai lai comot from Senator Dino Melaye bonk until them arrest am. The Police come send more than 50 additional policemen join d ones wen dey before go Melaye caban wen dey for number 11, Sangha Street, Off Mississippi, Maitama, FCT. Meanwhile, tori dey play say d olokpa dem go fit use by force take arrest the lawmaker wen neva gree comot from him house since last Friday.
I Neva Dump APC
Imo State governor Rochas Okorocha don talk say d news wen dey play say he don dump he All Progressives Congress (APC) den forward march enter the Action Alliance (AA) no be true. Wen the governor dey yarn yesterday, he come talk say na those people wen get stolen tickets nia dey behind the blackmail. He come talk say he still tanda for d APC and say he go continue to work for President Muhammadu Buhari re-election and the victory of other APC candidates wen their way pure.