Naija music star and top singer for Flyboy Inc.’s Kizz Daniel don shock him listeners with one new vibe wen he call “Pano Tona” This track dey follow him previous jam “Mahraba” for back. Kizz Daniel carry Adekunle Gold join body for this track and he con combine the skill of Philkeys , Blaise Beat and Reward Beats take produce this track.
Obaseki Dey Fear EFCC Nai Make Am Run, Edo Govinor-elect
As di 8 years wey Govinor Godwin Obaseki time die office go finish tomorrow, rumour dey fly say he don run komot from Nigeria make dem nor catch am. Na di new Govinor, Monday Okpebholo wey go take over on Tuesday nai say fear don enta Obaseki heart cus of all di yeye tins wey he dey do for di state since 2016. Tuesday November 12, nai Okpebholo go sitdon as Govinor of Edo State but he don dey hit am since say wey Obaseki komot from office, he door gate nor go far from where Economic and Financial Crimes Commission (EFCC). Di statement wey di new Govinor release thru him aide say na since on Friday nai dem nor see Obaseki again for Govimet haux and even porchu all di workers wey dey with am. But even with di alarm wey Okpebholo blow, sources outside say nor be true as dem see Obaseki for Lagos on Sunday nite.
Free CS For Nigeria Women Wey Get Belle –Federal Govimet
To make sure say women wey get belle nor dey karey die anyhow as dem wam born pikin, Federal Govimet thru Minister of Health and Social Welfare, Prof. Muhammad Pate, don announce say na free women go dey go operation from now on. Na during dem teree days Nigeria Health Sector–Wide Joint Annual Review for Abuja, nai deme take bring di new level so that e go reduce di way women and new born baby take dey die for di kontri cus dem nor get moni to karey out operation. Di Minister say e nor be beta tin say woman wey dey bring life, go come die did di process cus of say dem nor get moni to karey out operation. Right now di new scheme na for every woman wey poor or nor know how she wan take pay hospital operation moni weda na for private clinic or govimet hospital, di National Health Insurance Authority go take care of am.
Ghana Vex Why Dem Put President Image For Front Of Hospital
President Nana Akfuo-Addo of Ghana wey he time for office go soon finish afta di two tenure wey he don rule, nai dey face tok from he kontri pipo cus of image wey he karey put for Western part of di kontri. Di minister of Western Region, Kwabena Okyere Darko-Mensah, on Wednesday, nai put di Presido image for front of Effia Nkwanta Regional Hospital, say dem use am to honor di president for he good work. Some pipo just dey provoke for di image , call am yeye tin wey nor make sense and even di opposition party member Emmanuel Armah Kofi-Buah say no be image nai Western Region need but to get beta epp. Even as some dey vex for social media, others dey hail Akfuo-Addo say he try and do beta work wey Ghana pipo see clearly.
Nigeria Dey Jump Enta CNG, Malaysia Dey Band Am
Some pipo for Nigeria don dey vex for di CNG initiative wey Federal Govimet bring afta dem komot fuel cus as e be naw, Govimet of Malaysian wey don dey do CNG since 1995 tok say dem dey stop am for July 2025. Na di Transport Minister of Malaysia, Anthony Loke, nai tok for press meeting say afta pesin don use CNG for long time e nor go come good for pesin to use again as e for cus big harm. He say di time wey CNG fit stay nor pass 15 years and afta then of pesin nor change am nai be say na disater go full everywhere. Di Malaysia govimet promise say dem go bring epp to those wey get Natural Gas Moto but for Nigeria CNG just dey start and Federal Govimet say nai cheap pass moto wey dey use fuel.
Bandits kill 10 piple for Niger State
Plenty bandits wen ride okada burst enter one farming community for Niger State and na so dem come kpuff nothing less than 10 residents, including women and children. The bandits slaughter some of the women wen no gree make d gunmen rape dem. According to report, d matter happen for the early hours of Tuesday when the residents dey prepare to go their farms. According to one source wen talk on top d matter, he say d matter happen for the Wayam community of Sabon-Gari District for the Rafi Local Government Area of the state.
Dogs Chop Security Guard Die For Lagos
One security wey dey work as guard for Pinnock Estate for Ilasan wey dey for Lekki nai dogs wey Salisu Mustapha get don chop die on Wednesday. Lagos State Police Command nai bring di mata come out for dem handle for X, say dem don arrest di owner of di dogs. According to tokpesin of Lagos Command, SP Benjamin Hundeyin, he say Mustapha no lock where di dogs dey well, na from there nai di teree dogs take run find dem way reach where do estate security dey, chop di guy die. Right now Hundeyin say dem don hold di dogs for one side dey wait for investigation to finish bifor dem go know wetin to do but say di Commissioner of Police, CP Olarenwaju Ishola, don say make pipo nor worry justice go prevail.
Police Kill Two Tiff Wey Dey Disturb Ughelli
Some ole wey dey disturb pipo for Ughelli and places around nai Delta State police don kill two for were dem take dey hide for Ewheru-Patani Road and even kolet some shakabula wey dem dey use take do operation. Wetin Delta state PPRO, SP Bright Edafe tok on Wednesday for Warri, say di tiff kidnaper na thru di Operatives from Commissioner of Police Special Assignment Team nai dem take catch di bad guys afta dem get beta info of how dem dey waka. On October 28 nai di police enta Ewheru-Patani Road but bifor dem go turn look di kidnapers don surround dem with gun, na there shooting start wey two if di tiff come wound. Small time as dem rush di tiff reach General Hospital for Ughelli nai dikitor say dem don die. With small investigation wey police don do, dem say na dis gang dey disturb Ughelli, Oghara, Mosogar and even pipo along Warri-Sapele road.
America Go Dey Strong And Safe As I Don Enta Power, Donald Trump
As dem don vote Donald Trump as winner of di United States Presidential election, he don dey greet America pipo say make dem nor fear as di kontri go dey safe and strong for all of dem. Nai di Presido elect say na golden period nai America don enta as all di pain wey dem dey feel since, dem nor go get am again as he don enta as di 47th presido. Na for Florida nai Trump take dey tok am , come say di problem wey karey eye look dem directly nor bodi think say dem go come out strong like dis. Even sef, di President of Nigeria President Bola Tinubu don use he Special Adviser, Bayo Onanuga take send congratulation message to Trump.
Army Chief Lagaba Don Die
Di Chief of Army Staff, Lt. General Taoreed Abiodun Lagbaja, nai Presidency don annonce say he don cross over to di other side for only 56 years wey he dey. For statement nai di Special Adviser of Presido Bola Ahmed Tinubu wey dey epp am tok on Information and Strategy, Bayo Onanuga take say di Army chief die on Tuesday nite for Lagos afta he don dey battle with small sickness. Presido Tinubu come dey tell di wife Mariya and dem two children join with family pipo make dem take am easy with cry as dem papa don die.