As dem don vote Donald Trump as winner of di United States Presidential election, he don dey greet America pipo say make dem nor fear as di kontri go dey safe and strong for all of dem. Nai di Presido elect say na golden period nai America don enta as all di pain wey dem dey feel since, dem nor go get am again as he don enta as di 47th presido. Na for Florida nai Trump take dey tok am , come say di problem wey karey eye look dem directly nor bodi think say dem go come out strong like dis. Even sef, di President of Nigeria President Bola Tinubu don use he Special Adviser, Bayo Onanuga take send congratulation message to Trump.
Army Chief Lagaba Don Die
Di Chief of Army Staff, Lt. General Taoreed Abiodun Lagbaja, nai Presidency don annonce say he don cross over to di other side for only 56 years wey he dey. For statement nai di Special Adviser of Presido Bola Ahmed Tinubu wey dey epp am tok on Information and Strategy, Bayo Onanuga take say di Army chief die on Tuesday nite for Lagos afta he don dey battle with small sickness. Presido Tinubu come dey tell di wife Mariya and dem two children join with family pipo make dem take am easy with cry as dem papa don die.
Equatorial Guinea Stop WhatsApp To Send Video Afta Kerewawa Sex Tape Of Minister
Video of Baltasar Engonga wey be di Director General of National Financial Investigation Agency for Equatorial Guinea, scatter everywhere as dem see over 400 sex tapes did he house and office wey he take dey nack him broda wives and other women. Na officials of ANIF nai see di video CDs did he office wey dem dey investigate di 54 years man. Cus of di way di kerewawa video don already for social media, nai di kontri Govimet tell di telecommunication company for Equatorial Guinea make dem make pipo nor fit dey transfer audio, video or any file with dem data for WhatsApp. Many of di pipo dey complain as dem nor for use WhatsApp take send tins unless say na WiFi, while di govimet say di move na to reduce wetin nor good wey pipo wan send.
Davido- Awuke ft. YG Marley
Naija musician and songwriter Davido don drop him new single “Asuke”. Na on the 31st of October 2024 nai Davido release the track. The tack nai be him first single for 2024. Davido feature Jamiacan singer YG Marley for the track. The track dey show Davido style and e go dey inside he album wen he go release later this year. Moonlight Afriqa join write the song and Mikakabeatz and Marvey Muzique Join produce am.
#EndBadGovernance Small Children Protesters Don Komot From Prison
Afta M.D Abubakar wey dey epp represent di Attorney General of di Federation, put application make dem free di small #EndBadGovernance children wey police hold come karey go court, di Federal High Court for Abuja don free 119 of dem. Dem put in for di case to cancel am and take over di mata wey dey bifor di judge of di court, Justice Obiora Egwuatu, and all come gree to stop di case against di children. Di release dey come afta Presido Bola Tinubu tell di Attorney-General and law enforcement agency make dem sharply free di small children for prison.
EFCC Don Arrest Ifeanyi Okowa For Port Harcourt
Di Govinor wey just komot from Delta State, Ifeanyi Okowa don land for Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) afta dem arrest am say he chop di state moni put for pocket. Dem arrest Okowa cus of N1.3 trillion wey be di 13 percent derivation fund wey dey come from federal govimet to all state wey dey produce oil from 2015-2023. As e be dem say Okowa use he office as Govinor take dey tiff di moni, use am buy property and other tins keep under bed bifor dem catch am on Monday. . Even tokpesin Dele Oyewale, say dem arrest Okowa when he come dem office for Port Harcourt but he nor gree tok more than that.
Family Provoke Afta Police Give N100k To settle Death Of Woman For Nasarawa
Di families of Ashenenye wey dey stay for Nasarawa State, dey vex as dem pikin wey be 35 years die for police hand, then later police bring N100k make dem take do burial. Patience Akla Ashenenye dey on top okada with her teree months pikin wey one Hilux van from govimet house jam dem for October 21, 2024, for back of Ta’al Conference Hotel, close to School of Health for Lafia. As di accident hapun nai dem rush Ashenenye, her pikin and di okada man, Tasiu Mohammed to Federal University of Lafia Teaching Hospital, but afta 20 minutes nai di woman die. Di broda of Mrs Patience, George Akube wey dey tok to Foundation for Investigative Journalism, FIJ, say two days afta di sista die, dem dey do wake keep when two DPO come say dem come greet di family with N100k to take epp dem. Akube say dem reject di moni even his sista inlaw cus na justice nai dem want for dem own come join di small teree months boy wey still dey hospital dey take treatment for leg wey break. Even di State Police Command PRO, Ramhan Nansel, say really di CP Umar Shehu send pipo to meet di family and give dem moni to epp reduce stress and still go pay for di other two wey dey hospital. But he come say even di police officer wey jam dem still go police clinic for Lafia for treatment cus shock enta he bodi but afta dem discharge am nai he go greet di family. Say that one nor still stop di CO not to give justice for di death of Patience.
Sickle Cell Pipo Get Chance To Survive Afta Operation For Lagos
No be small sumtin nai di Lagos University Teaching Hospital, LUTH, don do to give hope to pipo wey get sickle cell disease afta one bone marrow transplant wey dem do for two patient wey get di disease. Di two na one mature pesin and anoda one wey be children dokitor nai dem bin admit did di Sickle Cell Foundation, Marrow Transplant Center for Lagos. Di tin wey dis transplant don do for di pipo life nor be small as na even beta name don gum Nigeria for West Africa side to fit do dis kind operation. Two of di patient don go house but di hospital still dey observe dem and as e be, na like 127 pipo nai dem wait for di Sickle Cell Foundation of Nigeria, SCFN, wey colabo with LUTH to make sure say pipo wey get di sickness fit come out well again.
National Association of Seadogs visit communities for Udu wit medical care
Relief come for families and people of Egini and other communities for Udu Local Government Area of Delta State, as the team of the National Association of Seadogs (NAS) visit the community to give free public healthcare services based on their routine medical outreach for communities across Naija. Hundreds of people for Egini and other Communities wen dey near, women, children, youths and te en old people gather for Egini Primary Healthcare Centre for the town to take advantage of the free medical services wen come their doorstep. The free healthcare service wen the NAS run dey happen for dis critical period when public medical services for Nigeria don get k leg becos of d back to back strike wen the National Association of Resident Doctors (NARD) dey fire down with, meanwhile the Chairman of Udu LGA Hon Vincent Oyibode come hail the initiative say dem finish work. NAS Chief Operating Officer wen dem dey still dey call the Pyrates Confraternity, Doctor Kenechukwu Eneli come talk say the outreach na one of the humanitarian services of the association, and say the medical service na for the primary level of healthcare. Meanwhile some of the people wen this good thing touch come thank the association of seadogs as dem come to d rescue of these communities unto say na opportunity for them to get access to medical attention.
Presido Tinubu go swear in new ministers today
President Bola Tinubu go swear in seven new ministers today after he recently reshuffle him cabinet. Na Bayo Onanuga, special adviser on information and strategy to the president nia confirm the development on Sunday. Meanwhile, the ceremony dey expected to take place for the council chamber of the state house, Abuja. Sunday Dare, the special adviser on public communication and orientation to President Bola Ahmed Tinubu don talk say “the label” wen dey ring say the administration dey favour south-west wen w come to appointing heads of security agencies no follow. For one post for hin X account on Sunday, the presidential aide share one table wen dey made up of the heads of 20 security agencies and the region of the country wen dem come from. Whereas, he do dis one becos of wetin people dey talk as Tinubu take appoint Olufemi Oloyede as the acting chief of army staff (COAS).