Di Deputy Presido of Kenya, Rigathi Gachagua wey dem porchu from position don dey go appeal jorjimet say di teree judge wey sitdon for di proceeding nor suppose to. Na di lawyers of Gachagua wey John Njomo lead nai say di Deputy Chief Justice Philomena Mwilu over do cus she go out so teree judges and normally nor be her right na di Chief Justice for di kontri nai get di right. Bifor di appeal di one teree judge panel don say wetin justice Mwilu do no bad cus di Chief judge even say she get di right for some kind case to wey just come up. Even with that one Gachagua belle still dey bitter as he dey beg di Court of Appeal to tell High Court make dem nor resin di proceeding until dem look am well in and out.
Make Una Stop That 18 Years Admission Mata, Court Tell JAMB
Afta Joint Admission and Matriculation Board, JAMB, don do di one wey dem know say any bodi wey dey find admission to university must don reach 18 years first, one foma Nigeria Bar Association Chairman for Warri branch come vex drag JAMB to court. Barrister John Aikpokpo-Martins, say he nor happy with wetin di board even tok say di restriction na for next year pipo wey wan write JAMB nor be dis year student but lawyer nor gree he drag JAMB and Edwin Clark University go Delta State High Court in Warri. For jorjimet wey di court come give, nai nai dem tell JAMB make dem nor even resin that 16 years mata for any skool wey dey di kontri and just wait till dem hear any other tin about di mata but for now dem don troway am for bush.
Presido Tinubu Close Niger Delta, Sports Ministries
As Presido Bola Tinuba don bin say he go change some tins for di administration e don hapun as Sports Minister, John Enoh and Niger Delta Affairs Minister, Abubakar Momoh nor know where to stand again. Tokpesin of President, Bayo Onanuga nai announce on Wednesday say Niger Delta Ministry and Ministry of Sports Development nor dey again afta dem close di ministries for Federal Executive Meeting, FEC, today for Abuja. Na Ministry of Regional Development nai go dey now to control all di Regional Development Commissions wey bin dey. Then National Sports Commission nai go take over Ministry of Sports. Dem come still say Ministry of Tourism don join with di Ministry of Culture and Creative Economy.
FG Drop Moni Laundering Case Against Binance
Federal Govimet wey heap case of moni laundering for Binance Holdings and di executive, Tigran Gambaryan, dem don take back di case. Na on Wednesday nai govimet make u-turn for di charges wey dem bin give Binance. Remember say EFCC bin arrest Gambaryan and he second, Nadeem Anjarwalla, but Anjarwalla run from National Security Adviser office where dem take keep di two executive, bifor dem come karey Gambaryan go dey for Kuje prison.
Enugu Boy Die Afta Native Dokitor Bury Am Alive
One native dokitor wey he name na Enuwa Odugu, 48 years, don land for Enugu State Police Command hand as he kill one Chikwado Celestine Eze afta di papa Uwakwe Eze, 67 years call am to do jazz for di young man. Chikwado wey be 26 years dey ready to travel to obodo oyibo, come tell hin papa wey say make di son travel come dem village Ugbaike, Enugu Ezike, Igbo-Eze North LGA first so that dem go do jazz wey go make am succeed for abroad. Afta di papa don force di son nai dem reach Enuwa Odugu wey be di native dokitor for di jazz but he say one of di tins for di jazz na to bury Chikwado for 1 hour and 30 minutes. Naso dem bury finish, time to bring Chikwado come out na deadi bodi come out, dem even rush am to hospital but dokitors say he don already die. Police wey dey confam di mata thru dem Public Relations Officer for Enugu, DSP Daniel Ndukwe, dem say na on Tuesday nite nai dem arrest di papa and di native dokitor.
Pikin Wey NDLEA Shoot For Eye, Dem Don Run Leave Am — Family
Afta over one year wey National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, shoot small Eromonsele Omhonria and he broda Ivan wey be two years die, as dem dey their mama shop. That time Eromonsele na just one year for July 2023, wey NDLEA bullet touch he eye and afta di first treatment di agency don run leave dem. Na wey di papa and mama of di small boy go House Committee join with dem lawyer and representative of NDLEA, nai dem take dey tok how NDLEA dey misbehave since. Fidelis Omohoria say afta dem don try tire to get visa to travel to US as hospital tell dem to do but e nor fit work as NDLEA nor dey show bodi put for di mata to bring di right documents. Wey Matthew Edaghese di family lawyer come dey tok, he say Eromonsele dey pass thru pain cus when he dey cry di tears dey mix with blood and not too long small glass fall from di eye. Nai make dem dey sue NDLEA for N2 billion but di committee say that moni too much for NDLEA cus dem nor go fit pay but dem go sharply send two years Eromonsele go abroad for treatmen
Cameroon Presido Show From Land of Di Dead
President Paul Biya, wey be di presido for Cameroon don land from where he go as pipo dey celebrate he return, join with di wife, Chantel, wey stand near am. Di 91 years man come back to di kontri thru Yaounde International Airport, afta pipo don karey rumour say di man don die cus nor bodi don see am again afta wey dem see am for China-Africa summit wey dem do for Beijing, September 2024. Na some weeks back tok start to dey fly say be like Presido Biya dey sick and he don die cus nor bodi know weda he really dey alive or not.
Immigration Officers Catch Bobrisky For Seme Border As He Wan Japa
Just to run komot from Nigeria make nor bodi know how he take japa, Idris Okuneye wey pipo know as Bobrisky nai immigration officers catch for Seme border on Monday. Na Martin Otse, VDM, first drop video update about di mata, dey call Bobrisky make he come deny am again bifor Nigeria Immigration Service come confam say dem hold di man wey dey dress like woman cus investigation dey go on for he head. Di Service Public Relations Officer, Mr Kenneth Udo, nai sign di statement on Monday evening say really dem catch Bobrisky for border and e nor go good say dem allow am run as na mata wey concern everybodi. Problem of Bobrisky first start with di moni laundering case, enta naira abuse, come enta prison, he come say he nor stay prison and some kind other tins wey he yarn for audio wey VDM bring to public.
Ndume Give Presido Tinubu Anoda Gbasgbos
Di Senator wey dey rep Borno Senatorial District, Senator Ali Ndume don troway anoda gbasgbos for di govimet of Presido Tinubu again. Dis time he say bad policies and changes wey nor dey make sense nai pipo wey dey position dey karey give Presido and now APC don tok dsm own. Remember say APC bin don troway Ndume komot as Chief whip of Senate bifor dis new tok wey hin say di sufaness too much make di govimet do sumtin bifor tins bad pass as e be. Wey di National Publicity Director of APC, Bala Ibrahim, come dey ansa Ndume on Sunday, he say make di senator karey any mata straight to Presido Tinubu instead of to come out dey come tok am outside. Ibrahim say freedom dey to tok but nor be e mean say pesin go dey yarn opata for outside as any pesin fit change di word but dem as a part still dey look Ndume.
Papa Summon JAMB To Senate As Dem Nor Release Pikin Result
One man Onyebuchi Obioha don drag Joint Admission and Matriculation Board, JAMB, go meet Senate say dem nor gree bring out he dauta result. Di papa of 16 years Chizitere Audrey Obioha say make Senate do beta investigation for di mata cus as dem dem look am wayo full inside wey JAMB dey hide. Na tru Senator Neda Imasuen, nai di papa take send di petition give Senate and dem say for di exam hall one supervisor say he like di daugta give her number for paper for call but di pikin show he papa. As dem call di nuba dey warn am nai he change level say na wrong nuba. Dem say JAMB dey tok say na wayo Chizitere dey for hall, dem don do panel and all but still yet noting to show say di pikin do way and JAMB nor still one bring di result. Nai Mr Obioha say make dem force JAMB to show evidence from CCTV wey dey di center and any other material m, then if dem pikin do bad dem go manage am like that.