China Beijing Exchange (CBEX), wey dem say na digital asset trading platform and dem start with beta promised say dem dey open but bifor you know, water come pass garri as di system don collapse. Many pipo put dem moni inside but di investors don turn crier tank as all dem moni just sweep komot from di wallet , with that some jaguda don karey wahala reach CBEX office for Oke Ado, Ibdan, Oyo State. Di investors wey nor get joy again just use dem anger take dey scatter, tiff office chairs, television and anytin wey dey for di CBEX office. Aa e dey now no pesin for pawer don tok anytin about di CBEX but Securities and Exchange Commission (SEC) don bin say any company wey dem patter be like CBEX na wayo and dem nor dey registered with SEC.
JAMB and School Heads go decide NTMUS
The Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) meet with the heads of all tertiary institutions for Nigeria to decide the National minimum tolerable UTME score (NTMUS), wen dem dey still dey call ‘cut-off points’ for the 2025 Admission exercise. JAMB drop dis update for inside one statement wen their otota Fabian Benjamin drop on Sunday. The JAMB Admission Policy meeting na one wen dem dey hold every year with heads of all university polytechnics and colleges of education –both public and private– to decide the ‘cut-off point’ for admissions from the 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME). Meanwhile, Jamb don release the results of the 2025 Mock Unified Tertiary Matriculation Examination wen candidates write on Thursday, April 10. JAMB yarn dis ok for inside one statement on Sunday. According to the board, the mock UTME dey aim to test their yearly innovations plus say e go still give candidates d opportunity to experience the computer-based test environment ahead of the main examination.
US Court don begin dey touchlight Tinubu ontop drug trafficking mata
The United States court for the district of Columbia don order the Federal Bureau of Investigation (FBI) and Drug Enforcement Administration (DEA) to release records of their investigations on the alleged involvement of President Bola Tinubu for drug trafficking. Beryl Howell, the district judge, on April 8, give ruling say d FBI and DEA “must search for and process non-exempt records” in line with the Freedom of Information Act (FOIA) requests. 2022 and 2023, Aaron Greenspan, one American and founder of PlainSite, file 12 FOIA requests with six different US federal government agencies to request the criminal investigation information of the Chicago heroin ring wen operate for the early 1990s.
Restructure police for Abraka – DSTG
The Special Assistant to the Delta State Governor on top Security Matters,John Enamuotor, don call on the Delta State Commissioner of Police to restructure the personnel for the Abraka Police Division, say kidnappings and related crimes dey increase for the area. For one formal letter, Enamuotor say he really dey concerned about the increasing insecurity for Abraka, den he come talk say part of the issue na the long tenure of some police officers—particularly the Divisional Police Officer (DPO)—when he say don serve the community for 10 to 15 years. He come give warning say that kind extended postings go fit lead to overfamiliarity with local crime suspects, and dis one go come end up to undermining the officers’ effectiveness. The SA come recommend the immediate redeployment of officers wen don serve for Abraka for more than ten years especially the DPO.
Dangote Fuel Price Don Drop Go N865
Pipo go soon start to dey happy as dis month of April go make sense for where fuel dey cus di price don come down with N15. Na for Dangote refinery nai di information take come out say make all marketers and customers dey happy cus di N880 wey dem dey buy fuel bifor na N865 nai e go be now. On Thursday morning nai Dangote tell all customers publicly and tori even confam am for petroleumprice.ng.
Umejei road project na expansion project – Comr. Izeze
Delta State Commissioner for Works (Highways and Urban Roads), Comrade Reuben Izeze, clear the air on Tuesday say the Umejei Road project for Ibusa, for Oshimili North Local Government Area of the state na for expansion and not dualisation. Comrade Izeze wen yarn dis one for one interview with news people shortly after he don inspect the 4km road project, come talk say he get to clear the air becos of wetin people dey talk about the project. He come tell Deltans say make dem no misrepresent the state government on any issue as government, according to am, na one institution wen get spokespersons and its media aides, den he come talk say d government go speak through recognised government officials. The Commissioner come talk say d state government approve d road for expansion and not for dualisation, say the Governor directive on the project dey clear enough.
Which Church To Go, Don Scatter Marriage For Plateau State
Couple wey bin plan dem wedding for April 5, 2025, don say dem nor do again cus of which church dem go dey go afta marriage. Yakubu Azi Abok and Patience John Addra dem two na from Plateau State and di joh of dem big day start to sour afta di bride wey be strong Catholic say she nor go change church afta wedding. Dem bin go dem last counseling class wey di Reverend come ask dem which church dem go attend togeda as husband and wife nai Patience wey be Catholic say she nor fit she church, di husband say lie lie na COCIN dem must attend togeda. As Fada sew di way di two dey behave nai he ask weda dem neva settle di mata bifor but di groom come say he mama tell am say di wife must go he church with am or dem go scatter di marriage. Tori say as di bride hear di mata nai she start to vex say weda na di mama wan decide for di groom, if naso make everybodi waka. Oga groom reach haux download for he mama nai she say as Patience don tok am with her mouth make di marriage kukuma scatter bifor dem start am. Bride see say mata serious, beg tire but di day of di wedding reach, pipo wear dress to go celebrate and eat with di couple but nor bodi show for church or reception ground.
All Awa Members Go Take Over LP Offices As Abure Nor Wan Hear Word — Joe Ajaero
National Seketary of Labour Party, Alhaji Umar Farouk say dem go soon put mouth for di threat wey Nigeria Labour Congress Leader, Joe Ajaero tok cus of say court don sack Labour Party National President, Julius Abure. Wetin make Farouk tok so na cus of say Comrade Ajaero say he go tell all di union leaders wey dey di 36 states join hand plus di National Seketaria of LP for Abuja, to porchu Abure from di party. Ajaero start all di plenty tok afta Supreme Court say make Abure karey he chair komot from di position as LP National Leader. Na di tin come make Ajearo dey vex say even with wetin court tok, Abure and he team still dey karey demsef like leaders of di party but di National Seke say make pipo nor resin wetin Ajearo dey tok as na initial gragra dey worry am.
Petition To Komot Akpoti-Uduaghan Nor Get Beta Stand
Di petition wey National Assembly send to Independent National Electoral Commission make dem komot Kogi Central Senator, Natasha Akpoti-Uduaghan, from position, INEC don troway am for one side. For wetin INEC tok for statement inside dem website on Thursday, say according to section 69 of 1999 constitution pipo wey write petition nor follow di normal procedure and dem not go take am for now.
Papa and Step Mother Don Kill Children For DSC
One man and he wife wey dey stay for Delta Steel Company, DSC Township wey dey for Oruhwhorun , nai police don arrest with hin wife say na dem kill dem teree dautas. Di teree sistas park komot from dem papa haux afta dem papa nor wait reach one year wey dem mama die come marry anoda woman. As dem mama don kukuma die, na sometimes di girls dey visit di haux to see dem papa and step mother wey be close friend to dem mama bifor she die. Sombodi tok say di teree sistas bin go biday party nite bifor, come go dem papa haux go visit but di next morning wey pipo wake, na foam nai dem come out from all teree girls mouth di next day. Wetin di step mother confess be say, she nor wan bin kill di children but only wan make dem sick for some time as dem nor wan accept her as mama Di Public Relations Officer, (PPRO), Bright Edafe say make pipo relax cus dem must get to di bottom of di mata and let every bodi know.