Di Group Chief Executive Officer of Nigerian National Petroleum Company Limited (NNPCL), Mele Kyari, don komot from di company on Wednesday as na Bayo Ojulari nai go dey control tins now. Na President Bola Tinubu nai sack do Kyari join with all di board members wey enta for 2023 so that new tins go change for di oil company. Wetin Bayo Onanuga di Presidential tokpesin, tok be say, Pius Akinyelure still lost he position and dem karey am give Ahmadu Musa Kida. Al di six board members, non-executive directors, wey just get positions, na from today wey be April 2, 2025 nai dem work go start.
Senator Natasha Show Kogi With Helicopter Afta Curfew Ban For Kogi
Di homecoming of Senator Natasha Akpoti-Uduaghan, wey dey represent Kogi Central pipo laslas hapun today afta di Chairman of Okehi LGA say dem nor want anytin like rally and even warn police to follow di order fully. Di crowd from di five local govimet don already gada dey wait for Natasha for Okehi LGA wey she land with white helicopter. As she dey joyfully dey speak with di pipo, she open some secret about Godswill Akpabio and Yahaya Bello, come say Nigeria na free kontri and she nor dey break any law cus na Sallah she come celebrate with her pipo plus nor be political season dem dey. Bifor now, Senator Natasha don accuse Senate President, Godswill Akpabio, and foma Govinor of Kogi State, Yahaya Bello, say dem way nor pure as na dem dey wan use di rally take cus problem for di state nai make dem put curfew make she nor come home.
Load From Nigeria To Mali, Burkina Faso, Niger, Go Dey Pay Levy Now
Burkina Faso, Mali, and Niger don end dem free trade market with West African kontris wey dey around dem afta many years wey dem don sell freely under di umbrella of the Economic Community of West African States (ECOWAS). Na on Friday nai di teree kontri tok say from today go, any market wey dey come from Nigeria, Ghana and any oda West African kontri, dem go dey pay 0.5% levy fee. But dem say any tin wey get to do with humanitarian aid nor go join for dis levy as dem get to gada moni to fit take run dem own economic since dem and ECOWAS don tear paper but dem nor tok pass like that. For now ECOWAS never tok anytin about di levy but problem just dey rise like ijebu garri between di kontris and ECOWAS since.
Na Your Mama Be Dis Ok — Delta State Nor Wan Punish Nurse Osato Edobor Again
Di shouting wey authorities give Nurse Osato Edobor wey dey skool for Agbor Nursing College, Delta State, cus of di video wey she lost for TikTok wey dem dey sing “Na your Mama be dis,” dem don withdraw di query letter. Afta di “Na your Mama be dis” song wey dem sing to di First Lady of Nigeria, Senator Oluremi Tinubu, and e come dey trend for all social media, nai do skool say dem must punish Nurse Edobor. Later nai Delta State Commissioner say pipo just dey karey dey read anoda tin from di video, cus na cus First Lady treat midwives well pass di nurses nai make dem dey vex not be say dem nor like her as dem mama. But on Friday nai Omoyele Sowore come post say di Commissioner of Health, Dr. Joseph Onojaeme, don confirm say dem nor wan punish Osato again, dis one dey hapun afta pipo start to shout why dem go punish di nurse for notin sake.
2Baba Foma Wife, Annie Delete All Instagram Post
Pipo wey like Annie Macaulay Idibia, di foma wife of Singer, Innocent Idibia aka 2Baba don dey greet her say na new start for her as she don delete all messages for her Instagram. Annie don dey quiet since her husband, 2Baba say he nor do again and come dey follow Natasha Osawaru wey be lawmaker for Edo State. But on Thursday nai Annie come Instagram delete all her post, and all of this dey hapun days afta pipo see 2Baba with Natasha dey do shopping for one boutique for Benin. As Annie don delete tins for her page, nor tok anytin or even write sumtin sef, many pipo dey find explanation to wetin dey her mind.
I Like As I Curse Ezekwesili — Senator Nwaebonyi
On Tuesday nor be small gbege wey nearly lead to red eye nai hapun for di committee wey dey look into di mata of Senator Natasha Akpoti-Uduaghan wey say Senate President, Godswill Akpabio eye dey her bodi, bifor you know shut up don dey fly for air between foma Minister Obi Ezekwesili and Senator Onyekachi Nwaebonyi. Dem two don start to troway word as Nwaebonyi say Ezekwesili na disgrace to womanhood and get yeye lifestyle afta he say Ezekwesili tell am make he shut up and call am yeye pesin. But for Channels TV on Tuesday night, di Ebonyi North Senatorial District Senators say he nor regret wetin he tok as na Ezekwesili nai first open mouth curse am and as grandmama nor get respect for hersef he nor go respect her. He say dem call di foma Minister go come take oath as witness but she say she nor dey do nai him say he go do am to give evidence but instead of that Ezekwesili come say make he shut up, yeye pesin dey tok. Nwaebonyi say he respect Ezekwesili as woman, but she nor get di right to tok to am like that for public.
Man Kill Girlfriend and Dauta For Edo State Afta Quarrel
Argument between one Wealth Nnamdi and hin babe Osasu Isaac don make dem teree years relationship lead to kpufnes of mama and pikin on di 16 of March inside Edo State. According to neighbors wey dey for Idiangbona Street for Ovbiogoe community wey di two pipo dey stay, say Wealth pack dey follow Osasu dey stay with her teree years girl pikin but di two of dem na cat and rat for quarrel. Dem say di two don dey plan traditional marriage God March 29th as Osasu don already get belle and she dey very happy but wey dem start to quarrel on Sunday di neigbor come think say na dem normal way don start again. But afta di quarrel finish dem not hear any noise again till afta two days wey smell start to dey come from di couple room, nai dem call police. Wey di Police Public Relations Officer for Edo State, Moses Yamu, dey tok hin say na officers from Ekiadolor Division nai go force di door open wey di neigbor call dem only to see di woman deadi bodi for ground with cutlass cut for her head and di dauta deadi bodi on top bed. Benin police say dem don already start to find Wealth Nnamdi as na him be di nuba one suspect.
Hon. Ukodhiko don flag off skill acquisition program to celebate birthday
The member wen dey represent Isoko Federal Constituency, Hon. Jonathan Ukodhiko on monday flag off skill acquisition training empowerment for women and men of the constituency as he mark him 50th birth anniversary. The flag off ceremony to train and certify 73 constituents on airfresher/bleach making hold for the NULGE Hall of the Isoko North Council Secretariat for Ozoro. People wen mark present for the ceremony include the State Organizing Secretary of PDP, Delta State, Hon. Emmanuel Egbagbor, Executive Assistant to Delta State Governor, Chief Emmanuel Edevor and Senior Special Assistant on Political Matters to the Governor, Hon Daniel Tutumor plus including others. When the National Assembly member, Hon. Ukodhiko dey yarn, he come thank the National Board for Technology Incubation for their collaboration as dem take train the lucky beneficiaries of Isoko Federal Constituency as part of activities to mark him 50th birth anniversary and na so he come still congratulate the beneficiaries den he come tell them to take the skills acquisition empowerment programme seriously.
No help tuberculosis spread – NOA
The National Orientation Agency (NOA) don call on Nigerians to take proactive steps to stop the spread of tuberculosis (TB). Tuberculosis na contagious infection wen dey affect the lungs, and e dey spread by d time when any infected person cough, sneeze or release fluid wen contain the bacteria for air. Wen Tijjani Ahmad, the NOA director for Jigawa dey yarn on Monday for one event to take mark the 2025 World TB Day for Dutse, he come talk say e dey important for people to dey tested whenever dem get symptoms like steady cough, fever or weight loss. Ahmad come still talk say early detection and treatment dey very important for the gbege against TB, say the bacteria infection dey curable if only the people take d right medication.
If you do anyhow,you go see anyhow – NIMC
The Federal Government don launch crackdown on people and organizations wen dey involve for the unauthorised printing of National Identification Number cards, with the warning say offenders go face legal action. The National Identity Management Commission NIMC for one statement wen dem tender on Monday, say dem don observe am say cyber cafés and other bodies dey carry dey produce fake NIN cards and na so dem dey charge innocent Nigerians fire for the illegal service. The agency come talk say the act na violation of the NIMC Act No. 23 of 2007 den dem come warn Nigerians say make dem no dey use or accept such unauthorized cards as valid identification.