More than 10 pipo nai army don karey from anoda community wey be Olota say dem hand dey for di death of sojas wey die for Okuama on March 14. One pesin wey dey stay di community nai say na yesterday morning nai 200 sojas enter inside Olota community wey nor too far from Okuama, […]
17 Years Fake Hin Own Kidnap For Agbor
One boy wey be 17 years don land for Delta State Police hand afta hin fake say dem kidnap to kolet moni from e family. Di young boy dey stay for Okhumera quarter inside Agbor-Obin, and na for March 20, 2024, nai he family go report give police say dem don tiff their broda. Wetin […]
Actor Junior Pope Don Really Die
39-year-old actor, Junior Pope Odonwodo wey pipo know as Junior Pope don las las die. Na for inside River Niger nai di actor die yesterday afternoon wey dem dey do one film for Asaba but dem rush am to hospital and he still die. Wetin tori yarn be say Junior Pope and two other actors […]
I Dey Put Eye For Di Beta Side Of Life — Mabel Makun
Na for 2008 nai pipo start to happy say Ayo Makun wey dey sabi comedy don marry Mabel, wey di marriage come even kes to two children. For long post wey Mabel write for her Instagram nai she take dey confam wetin di husband bin post say their 20 years marriage don kick bucket. She […]
Jacob Zuma Wan Be President Again For South Africa
South Africa Electoral Court don give go ahead to foma President Jacob Zuma on Tuesday to contest as President for di next election. Wey Zuma finish as President, nai di court call am to ansa mata wey dey he head for corruption but di man nor gree show face, naso dem send am to prison […]
Pipo Dey Try Wan Make Us Tire For Di Nigeria-UK Travel, Air Peace Chairman
E never tay wey Air Peace start to dey travel straight from Lagos go UK but e dey be like say dem don dey get problem as di chairman of di airline, Allen Onyema say outside airlines dey try wan push am komot from UK travel space. As pipo don dey praise Air Peace for […]
Afta 16 Years Super Falcons Make Am To 2024 Olympics
No be small shout of joy nai full pipo belle afta di Super Falcons of Nigeria break di 16 years delay wey don dey hold di women football team for years. For inside Loftus Versfeld Stadium for South Africa nai Super Falcons take dash 1-0 to Bayana Bayana of South Africa to take quality di […]
EFCC Don Get Back N30bn From Betta Edu Investigation Case
Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC say dem don get fit return back N30 billion to do hakant of federal govimet base on di case wey dem dey investigate ontop di Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Betta Edu. To folow up for di mata nai EFCC take tok dis one on Monday […]
No Dey Kolet Dollar For Wetin You Dey Sell Or See Yoursef For Jail
Big warning nai EFCC don troway give pipo wey dey do business on Monday say dem nor wan hear or see say dem use dollar as means of exchange for any goods and service, pesin wey nor hear go land for jail. Na for dem latest edition of dem monthly e-magazine nai di chairmo Ola […]
Rwanda Marks 30 Years Anniversary of Pipo Wey Die For 1994
On Sunday nai Rwanda fight between di Hutus and Tutsis reach 30 years for di fight wey hapun for July 1994 and pass 800,000 pipo nai die. From dis week di kontri flag go deg fly half to remember di pipo wey die, dem nor play any music for radio, or even for public place. […]