Delta State Governor, Rt. Hon. Sheriff Oborevwori, don provoke becos of the attitude of some civil servants for the state when dey lie for their age with the wayo plan to prolong their years of service. Oborevwori warn those wen dey involve for dis kind matter to stop from dis kind wayo act or face serious sanctions. The governor give the warning on Tuesday evening for one dinner wen the state government organize for the College of Permanent Secretaries wen the State Head of Service, Mr. Reginald Bayoko; Heads of Extra Ministerial Departments; Directors and Deputy Directors for the state civil service lead and na for the Event Centre, Asaba nia d dinner for take happen. The Governor come tell civil servants wen don reach the age of retirement to retire from the service so as to create opportunity for younger ones to dey employed, and dis one na even as he still say make civil servants dey always dey put their real age for their documentations.
I Dey Vex For Fubura, He Know Wetin Go Bring Peace —Wike
Foma Govinor of Rivers State wey be Minster of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, say he nor dey happy with wetin Govinor Siminalayi Fubara wey he hand over parwa to dey do for di state and even di letter wey he write to di State House of Assembly na just useless tin. Fubura bin write letter thru di SSG, Tammy Danagogo to di lawmakers say dem want peace and even go bring di 2025 budget to discuss with Speaker Martin Amaewhule wey Supreme Court don already say make dem bring back. Di tok nor sweet for Wike ear and even some of di lawmakers come block Fubura make he nor enta di Assembly, but wey Wike come dey tell tori pipo for Abuja, he say Fubura just dey do di lawmakers and Speaker like say dem be he pikin and nor get any single respect for dem. Wike say Fubura know di right tin to do to bring peace as politician wey he be, cus normally he suppose call Amaewhule and he pipo to tok to dem privately nor be to dey write public letter wey nor make sense. But for Fubura part, he don gree say he go follow wetin Supreme Court tok a don don tell di Rivers State Independent Electoral Commission make dem do anoda fresh LGA election for August 9, 2025.
NCC,block ashawo websites – House of Reps
The house of representatives don tell the Nigerian Communications Commission (NCC) to direct internet service providers for the country to block all websites wen dey host pornographic and yeye contents with immediate effect. The house reach dis conclusion during their meeting on Tuesday based on d motion wen Dalhatu Tafoki, one All Progressives Congress (APC) lawmaker from Katsina state sponsor. Wen Tafoki dey move the motion, he come talk say cyber pornography don become global problem and say Nigeria never take enough steps to address d matter. He come describe Nigeria as a “highly religious country” where major faiths stand against seeing nakedness and immorality.
Put Military Base for Uromi,House of Rep tell FG
The house of representatives don condemn the insecurity for Esan north-east/Esan south-east federal constituency of Edo state. During their meeting on Tuesday, lawmakers tell the federal government, through the Defence Headquarters (DHQ), to establish one military base for Uromi, for Esan north-east LGA to help promote security for the area. The house pass the resolution after dem adopt one motion of urgent public importance wen Henry Okojie, one lawmaker from Edo state sponsor. Wen Okojie dey lead the debate on the motion, he come talk say the insecurity for the area don “reach critical point, with steady and increasing cased of killings, kidnappings, and other forms of violence”.
Make una tell Fubara to obey supreme court – Tinubu
President Bola Ahmed Tinubu don tell Niger Delta leaders to talk to Governor Siminalayi Fubara to obey the Supreme Courty judgment on the political gbege wen dey play for he state, say he dey put the responsibility for peace for the state on top their shoulders. Tinubu, talk this one on Tuesday wen he dey address political leaders from South-South wen dey under d umbrella of Pan-Niger Delta Forum, PANDEF, for the Council Chambers, Presidential Villa, Abuja. He come hammer on the critical need for obedience to the rule of law for Rivers State to ensure lasting peace and prosperity The President come still tell the stakeholders to make sacrifices for the state to move forward by recognising the constitution.
President Tinubu appoint new NABTAB oga
President Bola Ahmed Tinubu don appoint Dr. Mohammed Mohammed Aminu as the Registrar/Chief Executive Officer of the National Business and Technical Examinations Board (NABTEB). According to one statement wen presidential otota, Bayo Onanuga drop today, Dr. Aminu get Ph.D for Automobile Technology and Master’s for Procurement and Supply Chain Management. He dey bring him 28 years of experience for teaching, administration, research, and policy development dey come carry out dis him new role. But before him appointment, he serve as Director of Procurement for the National Agency for Science and Engineering Infrastructure (NASENI).
Commission of inquiry go release report for the land gbege mata -Gov. Sheriff
Governor Sheriff Oborevwori, don assure the people of Ogwashi-Uku kingdom and neighbouring communities of the sharp sharp study and release of white paper on the Commission of Inquiry report on the land gbege for the area. Oborevwori give the assurance when he dey receive the report of the Commission of Inquiry concerning the kingship/land ownership wen don dey go on for within Ogwashi-Uku Kingdom for Aniocha South Local Government Area and neighbouring communities for the state. He come talk say the findings of the committee go let the State Government know how this gbege take start and provide the road map towards achieving the goal of sustainable peace.
Boat Tumble For DRC Kill Football Players
Some pipo don die for boat wey tumble for Kwa River wey dey Southwestern part of Democratic Republic of Congo on Monday. According to di provincial tokpesin, Alexis Mputu, 25 persons nai don die and plenty of dem na boys wey go play ball for Mushie City wey dey Maï-Ndombe province and dey go back to den haux. Dem say na cause everywhere dark and di boat driver nor dey see well nai make di boat tumble plus be like pipo too Kuch inside, cause boat accident dey hapun wella for DRC. But di administrator wey dey did Mushie territory say 30 pipo survive for di boat and dem dey hospital for treatment.
Operation Hadin Kai don rescue 75 piple for Sambisa
Troops of Operation Hadin Kai don rescue 75 civilians from Sambisa Forest for Borno State. When the General Officer Commanding 7 Division of the Nigerian Army, Maj. Gen. W. Shaibu dey address news people on Monday during the victims’ their handover to the Borno State government for Maiduguri, he come talk say d victims wen dem rescue dey made up of 7 adult males, 34 women, and 34 children. The GOC, wen the Deputy Theater Commander, Brig. Gen. A.L. Akpodu represent come explain say dem rescue the civilians during one clearance operation wen the 21 Special Armored Brigade and the 199 Special Forces Battalion under Operation Desert Sanity IV carry out for inside Sambisa Forest.
Govinor Sheriff do well for Aladja and Ogbe-ijoh mata – Hon. Sylvester
Chairman of Warri South West Local Government area, Honourable Sylvester Oromoni don hail the State Governor, Rt. Hon. Sheriff Oborevwori, for meeting with stakeholders of Aladja and Ogbe-Ijoh communities for Udu and Warri South-West Local Government Areas of the state over settlement of their land gbege wen don tay. According to the council Boss, members of the peace committee of the Aladja and Ogbe-Ijoh crisis attend d meeting wen hold for the Osubi caban of the Governor. He say the two parties don agree to live in peace and say dem go follow the terms of settlement wen d two communities agree on. Honourable Oromoni come thank Governor Oborevwori for d way wen he take address d two parties, and na so he come still greet the youths and elders of both communities for agreeing to maintain and walk on the path of peace.