+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Bag Of Rice Wey We Seize Go Sell For N10,000 — Nigeria Customs

Nigeria customs say dem go start to sell food stuffs wey dem seize and dem go sell one bag of rice for N10,000.

Wey dem do press conference for Lagos yesterday to take start how dem go use take dey sell di food nai di Comptroller-General of the NCS, Bashir Adeniyi, say na way wey dem go use take make sure say food yakpata for di kontri.

He say Govimet don give go ahead make dem reduce di price of food to pipo wey be teachers, religion bodies, nurses, pipo wey dey manage small work plus other kontri man dem.

D custom oga say na di way pipo take dey karey food komot from di kontri dey go outside kontris Wey near Nigeria nai make tins dey hard like dis.

And some of di tins wey dem seize na over 20,000 bags of different tins like rice, beans, corn, guinea corn, millet, soy beans.

Then 963 bags dry fish, even dry pepper, tomatoes, cooking oil, Maggi, macaroni, salt, sugar, and garri.

He say na all dis kind tin dey make food scarce for di kontri cus if pesin wan karey food to anoda kontri he own kontri suppose don chop belle full.

Adeniyi say na only di custom officer by demsef go dey in charge of di supply so that no stories that touch go dey for di distribution. Join with say dem get guidelines wey go make sure say di good go to di right pipo.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM