+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Notin Like Coup For Military Mind, Make Nobodi Resin Am

Di Chief of Defence Staff, Gen. Christopher Musa, say all di pipo wey dey shout say make military take over, dem be enemies of Nigeria.

All dis one dey hapun on Wednesday afta di Overseeing Commisoner for Internal Security and Home Affairs for Abuja, Samuel Aruwan say dem don catch di pesin wey send pipo go attack Nigeria Defence Academy for Kaduna on August 2021.

Di troop don kill di pesin on Wednesday and military say dem stand gidigba with Nigeria democracy.

On Thursday wey di CDS dey tok to tori pipo for Port Harcourt, dem dey warn pipo wey dey tik of coup for di kontri to stop that kind tiking.

With all di protest wey dey hapun for di kontri cus of hunger and di way tins dey go, military still dey stand on say dem nor go ever go against govimet for di kontri no mata anytin wey hapun.

Wey di CDS dey tok for Port Harcourt on Thursday, Musa say anybodi wey dey plan coup nor like di kontri.

“We want democracy and we go make sure say e beta. Any pesin wey dey resin coup na bad belle cus di kontri go soon beta.”

Musa come still add say Wey sumtin wan beta naso e dey be but afta dis stage everybodi go smile.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM