+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Nor See Sack Of Gun For Weyinmi Hand — Police

No be true say di state commissioner of Youths, Mr Agbateyiniro Weyinmi dem see sack of guns for hin hand, dis na wetin di Delta State Police Command tok.

Different news just dey fly for social media say dem catch Weyinmi with sack wey guns full.

But Mr Bright Edafe di Police Public Relations Officer for di state inside statement wey hin bring nai say di pesin wey write dis mata wey spread like wide fire, just dey lie cus di pesin still say dem karey di gun give Ekpan Police Station then di Commissioner come take four of di gun to kip.

Edafe say di pesin write say Weyinmi tell one of him boys to karey di gun wey hin take use take go kill one olopka for Delta state.

Police say dem don luk wetin di pesin write wella and know say na just yeye talker and police nor get time to dey do tok back with am, cus notin like that even dey police record.

Di command say make tori pipo and even kontri men dem nor karey that kind news cus wetin di writer just dey find na to mislead pipo and cause problem for where problem nor dey.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM