+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Bandits Don Fall One Of Di Teacher Head From Oriire LGA

Di new mata wey dey ground about di teachers and skool shidren wey bandits tiff for Oyo on Friday don worst as di bandits drop video show how dem take kpai Mr. Micheal Oyedokun wey be maths uncle for Community High School, Ahoro-Esinele inside Oriire LGA.

Oyedokun join di seven teachers wey di kidnapa tiff from teree skools inside Oriire LGA and dem family don dey cry deg beg security agencies and Oyo State Govimet to try dem best make mata nor worst pass as e din already bad.

Di bandits use very bad way take kpai Oyedokun as dem tie am like okporoko, come dey force am to tok bifor dem use knife fall he head. But Dr. Suleimon Olanrewaju, di Special Adviser on Media to Govinor Seyi Makinde, don confam di di video on Monday but say dem dey use every possible means to bring all di pipo out safe.

He say even Amotekun wey dey try go epp naso bomb wey di bandits set kill some but hand don touch six pesin wey get konetion to di kidnap.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM