Shout don full everywhere to make sure say di shidren and teachers wey bandits tiff on Friday for Oriire LGA for Oyo State dem go see way come out above with no palava.
On sunday nai Afinefere di Yoruba socio political forum come dey say di shidren wey di bandits tiff from Baptist Nursery and Primary School, Yawota; Community Grammar School, Ahoro-Esinele; and L.A. Primary School on Friday, May 15, make di govinor look well to save dem cus as be naw insecurity don dey draw map for Yoruba land.
Na for Sunday statement nai di National Publicity Secretary, Jare Ajayi, take dey cry for Ibadan, Oyo State, say di kase dey worst and Yoruba just dey look sitson look until wata go pass garri but make di family pipo take heart cus dem go see all di victim alive
