+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Binance To Pay $10 billion fine To Federal Govimet

Di Nigeria govimet afta so many luk inside di way Binance cryptocurrency dey take make Naira yeye cus of dem policy, FG don give di trading platform $10 billion dollars fine.

Federal Govimet bin come out tok say dem don ban Binance crypto just few days ago, sake of say dem dey sell dollar rate wey Central Bank of Nigeria, CBN nor know about, wey suppose normally be CBN right to put price for exchange rate.

According to Bayo Onanuga wey be di special adviser for Information and Strategy to di present govimet, President Bola Tinubu, nai gada all di information drop give BBC on Friday inside interview.

Onanuga say all wetin Binance platform dey go na just ta scatter di naira with dem trade cus dem don bin remove naira from dem pesin to pesin transaction, wey come make Presido close di platform and even arrest two pipo wey dey work there.

Even CBN oga, Govinor Olayemi Cardoso say na $26 billion nai don pass through di platform for only Nigeria for just one year and dem nor know even know who di pipo be.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM