+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Foma Militant Wan Close Gas Plant For Utorogo Cus Of N320m

Di gas plant for Utorogo inside Otu-Keremi for Ughelli South LGA wey Phase 2 of ex militant of Presidential Amnesty Program say dem wan close, Chairman of Delta and Edo State chapter say dem nor go close am again.

Di foma militant write for news dey point finger say some pipo don hide 320 million naira wey suppose be for dem, for one kona.

Nai dem come dey beg Presido Bola Tinubu and di admin wey dey for PAP, Maj-Gen Barry Ndiomu (rtd) join with security agents make dem go find di pipo wey chop moni.

Base on that resin nai make di Delta State chairman, Solomon Adu, Edo State chairman, London Gbuke join with Julius Belemu from Bayelsa State for statement wey dem write say why dem wan close di gas plant na cus no bodi gree say na dem hide di moni not until di publication.

Even though dem nor call names, some pesin come out dey come tok, just to show say dem hand nor clean.

Di ex-militants say that N320 million wey some anoda ex militant hide suppose be for di whole Phase 2 Ex-militants wey dey for Niger Delta region.

Dem say this fight nor be just for dem belle but for di whole region and make president come chuk mouth put, cus di pipo wey rush go tok against di publication don open wetin dem do for back.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM