+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Tinubu Sack NCAA DG and Others, EFCC Tie Neck Dem

Di man wey be di Director-General of Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA), Capt. Musa Nuhu, don get sack letter from President Bola Ahmed Tinubu on Wednesday.

Statement wey Ajuri Ngelale, Presidential tokpesin for media bring, say dem suspend Nuhu so that EFCC fit investigate am join with other senior officials base on some kind kurukere.

As dem suspend Nuhu sharply naso dem karey  Chris Najomo make he dey as di acting DG.

Ngelale come say President Tinubu don tell Festus Keyamo, Minister of Aviation and Aerospace Development make he bring new vice-chancellor and other senior officers wey go dey for di African Aviation and Aerospace University (AAAU).

Before that one sef, Presido don still sack Kabir Mohammed wey di Managing Director of Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN).

Then Tayib Odunowo, wey be MD of Nigerian Airspace Management Agency (NAMA), still chop for di hot breakfast.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM