+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Burkina Faso, Mali, Niger, Karey Dem Bag From ECOWAS

Di kontri of Niger, Mali and Burkina Faso don wash dem hand and their leg komot from di Economic Community of West African States, ECOWAS on Sunday.

For statement wey di leaders of di teree nation release, dem say ECOWAS gragra too much so di military leaders don make up dem mind to vamus  with no luking back.

Dem say di way ECOWAS take sama dem sanctions say dem must komot from military rule nor be here and na even Niger and Mali own nai worse pass.

Small side of di statement wey di kontri release na, “Afta 49 years, di pipo of Burkina Faso, Mali, and Niger regret to say dem nor dey happy with di way ECOWAS don komot from wetin di pipo wey first start am dey do and dem nor get Africa spirit again.”

As di mata of say Mali, Burkina Faso and Niger dey komot from di bloc, nai ECOWAS raise hand to tom say dem ready to tok with di military kontri leasers t see how dem fit epp cus all of dem dey important as members for di group.

Wetin ECOWAS tok be say even dem never get di information direct from di mouth of Burkina Faso, Niger and Mali say dem dey komot from di group.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM