+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Scrape That Chinese Language Plan From Your Head, Eradiri Tell Gov. Douye

Di pesin wey wan be Govinor under Labour Party for  Bayelsa State, Udengs Eradiri, dey shake head for di tok wey Govinor Douye Diri bring come say hin wan make pipo dey learn Chinese language for skool.

Eradiri say nor be about to learn new language o, cus if pesin learn e gud but na which gud nai di language get to work for Bayelsa pipo.

He come dey ask make dem really sitdon luk well which kind friendship nai Bayelsa get with Chinese, weda n for culture, abei na political or say dem dey even sell market togeda, wey e be say skools go come dey learn how to speak Chinko.

Naso di foma commissioner say if e be say na even trade mata nai Gov Diri wan even use am for e for beta, but na which way di trade wan take pas wey e be say even di Cargo airport for di state don kpafuka for one side as abandon project.

Na Eradiri say give solution say e go beta make di state govimet luk di curriculum well and know di kind program wey go epp bring beta opportunities and beta tin come di state to put for wetin students go dey learn for skool.

He come use hand take point dey show Diri about Artificial Intelligence wey dem call AI for short, Information and Communication Technology, ICT,  learn how to do robotics and even agriculture cus those ones na wetin di world dey put bodi now wey go bring development and nor be to go skool go dey learn how to speak Chinese.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM