+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Cement Price Go Dey Between N7k – N8k, Govimet

With di new price of cement wey dey sell between N11, 000 to N13,000 govimet don call manufacturers wey dey produve dis cement to know how dem fit reduce di price.

Minister of Works and Housing, David Umahi say cement companies don gree to sell 50kg bag of cement for N7,000 or N8,000 depend on di location.

Dis na afta di long meeting wey di minister do with cement manufacturers, dem Dangote, BUA and Lafarge, cus di price of cement just jump from N4,000 enta 10k.

But di meeting wey Umahi do with di manufacturers, dem say dem go reduce di price if govimet do sumtins to epp dem solve di problem wey dem di cement industry dey face.

Dem say di price of cement go depend on di location for di whole kontri.

Naso Minister for Works come tell tori pipo say di resin wey make di price of di cement still dey high, join bad road, smuggling dollar and other tins.

But di manufacturers gree to reduce di price but e nor go be di same price for everywhere.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM