+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Chinese Restaurant Wey FCCPC Close For Abuja Dem Don Reopen Am

Afta di many tok wey don folow di Abuja Chinese supermarket come make Federal Competition and Consumer Protection Commission come lock di store, di owner Liu Bei don go meet FCCPC to tell dem wetin hapun.

Many pipo online start to dey vex afta one customer tok on Sunday say she go Chinese supermarket but di security say dem don stop to allow Nigerians enta inside the store to buy sumtin.

As pipo start to say Chinese supermarket nor fit dey for awa land dey tell us wetin to do naso FCCPC karey bodi, lock di supermarket and give sanction notice to the store owner.

Naso she wrote statement come even go FCCPC say her shop nor dey do like dat, cus any bodi wey wan enta buy sumtin nai dem dey allow even Nigeria pipo.

To confam di reopening of di store, di estate assistant manager, Sanusi Shaibu, say dem don solve di problem and FCCPC don go komot dem padlock from di store gate.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM